Queen Elizabeth II: World leaders remember 'kind-hearted Queen'

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Tiffany Wertheimer
- Role, BBC News
- Read am in 8 mins
World leaders and dignitaries don pay dey pay tribute to Queen Elizabeth II, wey die at di age of 96.
Dem don honour her deep sense of duty and her resilience, as well as di Queen sense of humour and kindness.
France Emmanuel Macron lead di tributes, remembering "a kind-hearted queen" wey be "a friend of France".
And former US President Barack Obama say di Queen bin "captivate di world" wit "reign wey dey defined by grace, elegance, and tireless work ethic".
"Time and again, her warm nature strike us, di way she dey make pipo relax around her, and how she bring her considerable humour and charm to moments of great celbration and circumstance," Oga Obama, wey meet di Queen on several occasions, tok for one statement.
Current US President Joe Biden describe di Queen as "more dan a monarch - she define an era".
Describing im visit to UK for 2021 as president, Mr Biden say "she charm us wit her wit, move us wit her kindness, and generously share wit us her wisdom."
Queen Elizabeth II meet 14 US presidents during her reign.
End of Di one wey oda users dey read well well

Wia dis foto come from, 10 Downing Street
Donald Trump say e no go "never forget Her Majesty's generous friendship, great wisdom, and wonderful sense of humour".
"What a grand and beautiful lady she be - nobody dey like her!" di former president write on im online platform, Truth Social.
And another former president, George W Bush, reflecte fondly on di time e spend having tea with Her Majesty and her corgis, describing her "great intellect, charm and wit".

Wia dis foto come from, Getty Images
Canada - wia Queen Elizabeth be head of state - don see 12 prime ministers during her reign.
An emotional Justin Trudeau say she bin get "an obvious deep and abiding love for Canadians".
"For one complicated world, her steady grace and resolve bring comfort to us all," di prime minister tok, e add join say e go miss their "chats" wia she dey "thoughtful, wise, curious, helpful, funny and so much more".
"She be one of my favourite pipo in di world, and I go miss her so," e tok, as e try hold back tears.

Wia dis foto come from, Getty Images
'An extraordinary personality'
King Willem-Alexander of Di Netherlands - wey be Queen Elizabeth fifth cousin - say im and Queen Maxima remembered di "steadfast and wise" monarch wit "deep respect and great affection".
And Belgium King Philippe and Queen Mathilde say she bin be "extraordinary personality... wey, throughout her reign, show dignity, courage and devotion."
Indian Prime Minister Narendra Modi remember im "memorable meetings" wit di monarch during two UK visits.
"I no go ever forget her warmth and kindness," im tweet. "During one of di meetings she show me di handkerchief Mahatma Gandhi give her as gift for her wedding. I go always cherish dat gesture."

Wia dis foto come from, Getty Images
German Chancellor Olaf Scholz pay tribute to di Queen "wonderful humour" and tok for statement say "her commitment to German-British reconciliation afta di horrors of World War II go remain unforgotten."
And Russian leader Vladimir Putin wey bin meet di Queen several times and one time tori be say im make her wait for 14 minutes, send im "deepest condolences" to King Charles III.
"Di most important events in recent history of United Kingdom dey linked wit di name of Her Majesty," Oga Putin write for statement. "
For many decades, Elizabeth II rightfully enjoy di love and respect of her subjects, as well as authority on di world stage."
Russia currently dey face heavy economic sanctions wey Western nations knack dem, including UK, because of dia invasion of Ukraine.
'A reassuring presence'
As monarch for seventy years, Queen Elizabeth live through times of extraordinary change, and dis reflect in several tributes.
As Barack Obama tok - she live "through periods of prosperity and stagnation - from di moon landing, to di fall of di Berlin Wall."
Irish President Michael D Higgins honour di Queen "extraordinary sense of duty" wey go "hold unique place for British history".
"Her reign of 70 years cover periods of very big change, during which she represent extraordinary source of reassurance to di British pipo," im tok for one long statement.
"Dis na reassurance based on reality of di significance of present events, rather dan any narrow conception of history."
Ireland's Taoiseach Micheál Martin speak of her reign as one of "historic duration" and describe di Queen death as "di end of an era".
"Her dedication to duty and public service bin show imsef and her wisdom and experience truly unique," Oga Martin tok for one statement. Im also remember her "many gracious gestures and warm remarks" during one state visit to Ireland for 2011.
António Guterres, UN secretary-general, say Queen Elizabeth bin be "a reassuring presence throughout years of sweeping change, including di decolonization of Africa and Asia and di evolution of Commonwealth."
For one statement im pay tribute to "her unshaking, lifelong dedication to serving her pipo. Di world go long remember her devotion and leadership."
Israel President Isaac Herzog also acknowledge di big change di Queen saw throughout her reign, but say throughout dis she "remain symbol of stable, responsible leadership, and example of morality, humanity and patriotism."
While di Queen no visit Israel, Charles, Edward, William and di late Prince Philip - wey dem bury im mama for Jerusalem - visit.
"Queen Elizabeth na historic figure: she live history, she make history, and wit her death she go leave a magnificent, inspirational legacy," President Herzog write.
Tributes also come from Latin American leaders.
Brazil Jair Bolsonaro write say Queen Elizabeth "no just be Queen of di British, but Queen to all of us."
"She be extraordinary and unique woman, her example of leadership, humility and love for her kontri go continue to inspire us and di whole world until di end of time", na wetin im call her. Di goment say dem go introduce three days of official mourning and invite all Brazilians to pay tribute to di monarch.
Argentina, kontri wey get centuries-long territorial dispute wit UK ova di Falklands/Malvinas islands, don send dia condolences afta di announcement of di Queen death.
"Di Argentine Goment greet and join di British pipo and Goment on di death of di Head of State, Queen Elizabeth II," President Alberto Fernández tweet.

Wia dis foto come from, Getty Images
African leaders also share dia tributes for Queen Elizabeth - wey know many of them well and, as di head of di Commonwealth, she bin get sympathy to dia cause.
Kenyan President-elect William Ruto praise her "historic legacy" and say Kenyans go "miss di cordial ties she enjoy" wit di kontri.
Kenya,wey be former British colony gain independence for1963, na very special place for di monarch. For a start, na dia she become Queen. Di young princess, then just 25 years old, bin dey on holiday dia wen her father, King George VI, die for her sleep in 1952.
President Ali Bongo Ondimba of Gabon, wey be one of di newest nations to join di Commonwealth, say: "Di Queen na great friend of Africa and Africa show her affection in return."
And Ghana President Nana Akufo-Addo tweet say im kontri get good memories of di two visits di Queen bin make, e tok about "her friendliness, elegance, style and joy she bring to perform her duties".
Her first trip to Ghana, wey also na former British colony, bin dey controversial and concerns bin dey about di monarch safety. Five days earlier, bombs bin go off for di capital, Accra, but di Queen no shake, sake of say she bin don already cancel one previous visit wen she bin carry Prince Andrew belle.
African leaders pay tribute to di Queen

Wia dis foto come from, Pool
African leaders join di rest of di world to mourn Queen Elizabeth II, wey die at di age of 96.
In tribute, African leaders describe di passing of di Queen as a 'great loss'.
''Di tori of modern Nigeria no go ever complete without a chapter on Queen Elizabeth ll, a towering global personality and an outstanding leader," Nigeria President, Muhammadu Buhari tok.
E add say, "di Queen dedicate her life to make her nation, di Commonwealth and di entire world a better place."
Ghana President Nana Akufo-Addo also Tweet message expressing im deepest condolence on di death of Queen Elizabeth II.
President Akufo-Addo say Ghanaians get fond memories of di two visit of di Queen to Ghana, remembering "her friendliness, elegance, style and sheer joy she bring to di performance of her duties".

Wia dis foto come from, Getty Images
For Ghana, flags go fly at half-mast for seven days from Friday.
Di President of Senegal and head of di African Union Macky Sall tweet im condolence saying: ''I hear di sad news of di death of Her Majesty, Queen Elizabeth II. I offer my heartfelt condolences to di goment and pipo of Britain.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Former Liberia President, Ellen Johnson Sirleaf also join oda world leaders to mark di historic and sad moment. She Tweet a picture of her meeting Queen Elizabeth II, for 2006, and say she dey honoured to visit di Queen.

Wia dis foto come from, Ellen Johnson Sirleaf,
Sierra Leone President Julius Bio dey deeply sad by di passing of Queen Elizabeth II.
President Bio say her dedication to di Commonwealth set example.
Ethiopia Prime Minister Abiy Ahmed extend im deepest condolences to di British Royal family on behalf of di goment and di people of Ethiopia.
Malawi President Lazarus Chakwera look back on di Queen visit to im kontri for 1979 wen im dey 24 year saying she captivate di imagination of Malawians.

Wia dis foto come from, Getty Images
"Di Queen commitment and dedication during her 70 years on di throne remain a noble and virtuous example to di world..", South Africa President, Cyril Ramaphosa tok for statement say her majesty na extraordinary and world renowned public figure wey live a remarkable life.
Kenya President-elect William Ruto say im go miss di friendly ties she enjoy wit Kenya. Oga Ruto say her memories kontinu to inspire Kenyans.

Wia dis foto come from, Getty Images
Burundi President Evariste Ndayishimiye say im dey deeply sad by di passing of Her Majesty Queen Elizabeth II,
"She be inspiration for generations around di world and go dey remembered for her great leadership.", e add.
"Di modern Commonwealth na her legacy", Rwandan President Paul Kagame tok via im official Twitter account.
Gabon President Ali Bongo Tweet say , di Queen na great friend of Africa and Africa show her affection in return.











