Equiano Cable landing Lagos: Google undersea cable land Nigeria, wetin public go gain?

Equiano Cable landing Lagos: Google undersea cable land Nigeria

Wia dis foto come from, Twitter/Jubril A. Gawat

    • Author, Daniel Semeniworima
    • Role, Senior Journalist

Equiano cable wey tech giant Google plan to enable a five-fold increase in average internet speeds dey land Lagos Nigeria, so wetin public go gain?

Nigeria na major landing point for di cable and di launch of dis digital access happun Thursday 21 April 2022.

"Dis Cable Landing [in Lagos] go provide approximately "20 times more network capacity" than di last cable dem build to serve di region."

Juliet Ehimuan, Director of Google for West Africa tok during one event to mark di launch.

Better data connection and cheaper Internet, job creation and more go follow di launch, one Lagos goment official tok on Tuesday.

Nigeria na Equiano second stop inside Africa, with future landings wey dey expected in Swakopmund, Namibia; and Melkbosstrand, South Africa.

Equiano, wey name dey inspired by a Nigerian, go dey land at different points inside Africa, much like a road construction wey dey progress.

Wetin you need to know as Google Equiano cable land Nigeria

Equiano Cable landing Lagos: Google undersea cable land Nigeria, wetin public go gain?

Wia dis foto come from, Other

Wetin we call dis foto, According to Google, di cable run from Portugal, through di West coast of Africa and all di way to South Africa.

Google Equiano na state of di art submarine Internet cable.

Di tech search engine, Google, alongside one of dia major partners, West Indian Ocean Cable Company (WIOCC) na im dey arrange dis project.

Di cable dey set to completely land on Friday, April 29, 2022.

According to Google, di cable run from Portugal, through di West coast of Africa and all di way to South Africa.

Di Internet cable, dey named after Olaudah Equiano, one historical abolitionist.

And Equiano Cable get power of 144 terabits (18 Terabytes) wit higher levels of durability than di last cable dem build to serve di West African region.

Tori be say for di landing site, wey dey Lagos island, dem plan to build massive new data centre.

Google office wey tanda for Lagos dey serve all di kontries inside di West African sub-region.

"Through this network infrastructure, we project say by 2025 we go don create at least 1.6 million jobs."

Na wetin Google West Africa Director, Juliet Ehimuan tell di BBC.

Di tech giant believe say dis infrastructure go boost Nigeria GDP by over $10billion dollars over a three-year period.

Di subsea cable na West Indian Ocean Cable Company build am wit funding from Google to provide Open Access to internet service providers and businesses.

Google Equiano Cable landing Lagos - wetin public go gain?

Equiano Cable landing Lagos: Google undersea cable land Nigeria

If you dey wonder, submarine Internet cables na one of di primary reasons you fit easily read dis article.

Na sake of dis technology you fit stream content on YouTube and Netflix, and upload content to WhatsApp and Instagram.

So submarine cable launch and increased Internet speeds in Nigeria na like cause and effect.

Nowadays, di average internet speed wey bin dey Nigeria na 18.7 Mbps, according to tech reviews - wey mean say internet data connection no too fast.

For example, if you currently get a download speed of 18.7 Mbps, e go take you over 7 minutes to download a 1GB file.

Back in di early 2000s, na very few pipo bin get phones and computers, and accessing di Internet dat time bin require buying time for cybercafe.

Even wen mobile phones become available, you go likely waste time loading one page wit plenti pictures or trying to stream a video.

As more business owners increase dia interest in Africa, technology begin to improve.

2009 record a major mile stone during di launch of di MainOne submarine cable, wey be one private submarine cable wey today spread between Nigeria, Ghana, and Cote d'Ivoire.

Afta dis launch, companies like Glo and MTN launch dia own submarine cables inside Nigeria.

And na so internet access too begin increase, and more tech companies begin open shop for di kontri.

Experts don tok say wit improved internet access, Africa fit catch up wit development across di continent.

All things being equal, Google Internet cable fit drop di average download time to 1.2 minutes from 7 minutes to download a 1GB file.

Di tech giant don commit demsef to invest $1billion inside Africa in di next five years to improve access.

If we believe Google claim, Equiano fit bring six times much faster Internet of 112 Mbps.

Lagos be like di silicon valley of Nigeria, sake of say na di one state wey get high technology innovation.

And di city wit over 22 million population na Nigeria commercial capital.

Anoda major public gain fit dey for speed and efficiency of your financial transactions.

Dis mean say you fit experience less time waiting for your mobile banking app to load.

And, hopefully, less waiting time for credit and debit alerts.

Some Nigerian telecom companies currently offer 1GB of mobile data for di rate of ₦666.

But all things being equal, dis fit drop to ₦140, according to wetin experts dey project from Equiano Cable landing.

Equiano Cable landing Lagos: Google undersea cable land Nigeria

Wia dis foto come from, Twitter/Jubril A. Gawat

Equiano Cable land Lagos afta Google Station

Google for July 2018 launch Google Station wey be dia fast speed internet station for Lagos, Nigeria.

Wetin sweet pipo belle dat time na say e no go cost anytin to use dis internet, because na free!

Na for Lagos Google announce dia partnership with Nigeria to bring free and fast internet to di masses.

Nigeria no be di first kontri wia Google don do dis kain tin for - India, Mexico, Thailand and Indonesia don dey enjoy am already.

Google Kontri Director for Nigeria, Juliet Ehimuan-Chiazor, say di plan na to make sure say more Nigerians participate for digital economy.

Google say anyone wey wan use dia free internet no need to worri about mago-mago pipo wey wan tiff dia personal information because di way dem don do am, e no fit happun.

  • The Palms shopping mall, Lekki
  • Landmark events centre, Victoria Island
  • University of Lagos, Akoka
  • MMA2 (Domestic Airport)
  • Ikeja City Mall, Alausa, Ikeja
  • Computer Village, Ikeja

Google Station wey don launch for Lagos go allow Nigerians to enjoy internet wey dey 'fast, reliable and no go drop', all dey need na to dey any of di six locations wey Google Stations wey dey di city.