President Buhari visit to Lagos: Buhari to commission Dangote plant, MMI airport

President Buhari visit to Lagos: Buhari to commission Dangote refinery, new airport

Wia dis foto come from, Presidency

President Muhammadu Buhari dey expected to visit Lagos on Tuesday.

Buhari trip to Nigeria commercial capital na to commission key economic infrastructure.

Di Nigerian leader go cut tape to open Dangote Fertilizer Plant for Lagos on 22 March, 2022.

Lagos international airport new terminal go also dey inaugurated by di president.

President Buhari visit to Lagos: Buhari to commission Dangote plant, MMI airport

Wia dis foto come from, Presidncy

Wetin we call dis foto, Di new terminal building at Murtala Muhammed International Airport, Lagos wey Buhari go commission for public on Tuesday.

Di new terminal go make di airport to fit deal with 14 million passengers each year.

Dangote Groups Fertilizer Plant, dey expected to function as di world biggest fertilizer plant.

Di plant wey get capacity of three million tons a year of urea and ammonia dey for Lekki district of Lagos.

President Buhari visit to Lagos: Buhari to commission Dangote plant, MMI airport

Wia dis foto come from, Presidency

During im Lagos official visit on Tuesday, President Buhari go also inspect ongoing work on di Lekki Deep Sea Port.

Wen e don complete, dis Sea Port wey dem plan to be multi-purpose, go be di deepest seaport for Nigeria.

And e dey projected to be one of di most modern ports inside West Africa.

President Buhari visit to Lagos: Buhari to commission Dangote plant, MMI airport

Wia dis foto come from, Presidency

Wetin we call dis foto, As at February 27th, 2022, di status of di Lekki Deep Sea Port project dey at 84.94% completion, according to presidential source.
President Buhari visit to Lagos: Buhari to commission Dangote plant, MMI airport

Wia dis foto come from, Twitter

Wetin we call dis foto, Lekki Deep Sea Port site

President Muhammadu Buhari last visit Lagos on Thursday, 9, December, 2021 to commission some projects of di Nigerian Navy.

Di projects include some new warships and boats for di Naval Dockyard Victoria Island.

Sake of di VIP waka wey dey involve for di Buhari trip to Lagos, di state goment say;

Dem don arrange alternative routes for motorists inside di kontri commercial hub.

On June 10, 2021 di Nigerian leader bin enta Lagos to commission di Ebutte Meta Terminal of Nigerian Railway Corporation Lagos Ibadan rail project.

Buhari bin promise for im election campaigns to boost Nigeria economy and experts believe say dis moves dey aimed at fulfilling dat promise to over 200 million Nigerians.

President Buhari visit to Lagos: Officials announce road diversion

Di presidential visit dey scheduled to hold between 8.00 am and 12 noon.

Lagos Commissioner for Transportation announce diversion sake of di expected movement of VIPs.

Dr Frederic Oladeinde say traffic management of di event call for the plan for alternative routes.

Oladeinde say motorists from Apapa/Oshodi go dey able to pass Agege Motor Road to link PWD connecting Works Road.

Or General Adeyinka Adebayo Road to access Oba Akinjobi inward Ikeja General Hospital and then connect Local Airport through di underpass.

Motorists on Agege Motor Road dey advised to link Charity by di Armed Resettlement Centre on di service lanes and make a U-turn for Cappa/Bolade axis inwards Shogunle to access PWD to continue dia journey.

Di Commissioner add say motorists fit go through di Third Mainland Bridge inwards Gbagada to connect Ikorodu/Maryland to reach di Airports as an alternate route.

He say officers of di Lagos State Traffic Management Authority go dey stationed along di alternative routes to help motorists navigate dia movement to ensure di free flow of traffic.