Holi greetings: India celebrate festival of colours as Covid cases drop

Students celebrate Holi at Panjab University on March 17, 2022 in Chandigarh, India.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Holi dey known as di festival of colours

Millions of Indians dey celebrate Holi, di festival of colours as Covid-19 cases for di kontri don drop.

Di festival bin no bubble last year because of di pandemic.

Holi na im dey mark di last full moon day of di lunar month.

Na time of beta jollification as pipo dey use bright colours dey rub demselves.

E also mean time of new beginnings.

Students play with colours on the eve of Holi festival, at Shankar Lal Ground of Delhi University, on March 17, 2022 in New Delhi, India.

Wia dis foto come from, Getty Images

Women play with colours on the eve of Holi festival on March 17, 2022 in Bathinda, India

Wia dis foto come from, Getty Images

On di day, food dey berekete for ground and dancing dey plenty.

Some pipo dey also pour flower petals on each oda to mark di beginning of spring.

Before di festival proper-proper, pipo go light big fire to show say good don win over evil.

Revellers smeared in coloured powder dance during the Holi celebrations, the Hindu spring festival of colours, in Hyderabad on March 17, 2022.

Wia dis foto come from, Getty Images

Devotees perform rituals during 'Holika Dahan' on the eve of Holi festival at Exhibition road on March 17, 2022 in Patna, India

Wia dis foto come from, Getty Images

Holi celebrations dey happun dis year without heavy coronavirus restrictions for India.

Around di kontri, crowds don gada for open streets dem dey celebrate.

A street stall selling colours on the eve of Holi festival, at Sadar Bazaar on March 17, 2022 in Gurugram, India

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, D festival na social top event for pipo wey dey celebrate
People dressed as Hindu deity Lord Krishna and Radha smeared with coloured powder, dance to celebrate Holi festival on March 17, 2022 in Kolkata, India.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Dem dey celebrate am with colourful dances and performances dem

Last year, many states wey include di capital Delhi bin ban large gatherings for Holi as cases of Covid-19 bin dey rise for di kontri.

Infections don drop well-well since dat time and India don dey get average new cases of 2,500 daily for some time. Dis make restrictions to come down evriwia.

E ginger di devotees and dem jolly di day wella. Pictures from di festival show as crowds wey cover demselves with colourful paint dey enjoy for di celebrations.

Children playing Holi during Chapak Holi Milan Samaroh at Hanuman Nagar Park on March 17, 2022 in Patna, India

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, As Covid cases dey reduce, large crowds dey gada to play Holi
Revellers smeared in coloured powder dance during the Holi celebrations, the Hindu spring festival of colours, in Hyderabad on March 17, 2022.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Restrictions on gatherings don dey eased around India

But goment and sabi pipo don warn against wetin dem call complacency.

On Thursday, di kontri health ministry tell states make dem maintain "heightened surveillance" as Covid cases dey rise for China, Singapore and some European kontris.

Revellers smeared in coloured powder dance during the Holi celebrations, the Hindu spring festival of colours, in Hyderabad on March 17, 2022.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Pipo dey happy say Pandemic no spoil dia Holi plans dis year
Devotees celebrate with colours, a day before the festival of 'Holi', at Govind Dev Ji Temple, in Jaipur, Rajasthan, India,Thursday, March 17, 2022.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Sabi pipo dey fear say cases fit rise for future