Ukraine Russia crisis latest: How European Union, African Union, oda world leaders react

European Commission President Ursula von der Leyen

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, European Commission President Ursula von der Leyen
Read am in 4 mins

World leaders and joinbodi dem dey respond as di world wake up to di invasion of Ukraine by Russia.

Di latest na from di African Union (AU) wey don raise concerns over Russia attack on Ukraine and dey call for an "immediate ceasefire" to avoid "planetary conflict".

Di union chairman, Senegalese President Macky Sall, and AU Commission chairman Moussa Faki Mahamat tok inside statement say dem dey "extremely concerned" by di invasion.

"Dem call on di Russian Federation and any oda regional or international actor to respect international law, di territorial integrity and national sovereignty of Ukraine," di statement add.

Di full-scale attack on Ukraine dey happun on several fronts afta Russia launch attacks from di east, north and south on Thursday.

Ukraine say plenti pipo don die, while thousands don run comot di kontri.

Soldiers of assault engineer and recovery-and-salvage units of the Russian Army 1st Guards Engineer Brigade

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin odas don tok?

"Dis na among di darkest hours for Europe since World War Two" - dat na di words of EU foreign policy chief Josep Borrell.

E say major nuclear power wey dey attack a neighbouring kontri and dey threaten any state wey come to im rescue na "di greatest violation of international law" and a "violation of di basic principles of human co-existence".

EU go impose di harshest sanctions e don ever give, e tok.

European Commission President Ursula von der Leyen, don condemn Vladimir Putin for "bringing war back to Europe".

She speak for Brussels as she announce say dem go propose a package of "massive" sanctions later in a bid to weaken Russia economic base and im "capacity to modernise"

She tok afta Russian President Vladimir Putin launch a "special military operation" for Ukraine eastern Donbas region.

Inside one televised address, e urge Ukrainian sojas wey dey face di Russian-backed rebels to surrender dia weapons and return to dia house.

Mr Putin say Russia no plan to occupy Ukraine, but warn say Moscow response go be "instant" one if anyone try to challenge Russia.

World leaders and joinbodi dem don condemn Russia.

Cars queue to comot Kyiv for di early morning of Thursday

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Cars queue to comot Kyiv for di early morning of Thursday

World leaders early reaction in bullet points

  • Ukraine' Foreign Minister accuse Russia of starting a full-scale war and ask UN to "do everything possible" to stop am.
  • US President Joe Biden don condemn di attack and vow d to hold Russia accountable.
  • Leaders from di UK, European Union, UN and NATO don also strongly condemn di Russian offensive.
  • One German government spokesman say Chancellor Olaf Scholz don speak to Ukrainian President Volodymyr Zelenskiy and assure am of solidarity.
  • UK Prime Minister Boris Johnson said he was "appalled" by the "unprovoked attack" and Britain would "respond decisively".
  • European Commission President Ursula von der Leyen, don condemn Vladimir Putin for "bringing war back to Europe".
  • Italian Prime Minister Mario Draghi say di action dey "unjustified and unjustifiable".
  • Meanwhile, Polish goment spokesman Piotr Muller say na "time to reinforce Nato eastern flank", e add say: "We expect say dem go take such decisions".

Fotos and highlight of wetin happun afta Putin announcement

Vladimir Putin announce di military operation into Ukraine T 5.55am Moscow time - and some minutes later dem launch di first shelling and missiles into Ukraine, according to reports.

For di capital of Kyiv, emergency siren begin sound, and fotos show plenti cars bumper to bumper for one expressway as pipo begin run from di city.

Social media testimonies say di sense of panic dey grow with some dey say dem dey rush dem inside bomb shelters and into basements. Television footage don show pipo for streets dey pray in groups.

Guardian journalist Luke Harding for Kyiv tok on Twitter say pipo dey streets, and pipo dey queue up for cash machines.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Pipo dey hug each oda for streets

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Pipo dey hug each oda for streets

Fotos of how tins dey for Kyiv afta Russia begin attack

Afta Russian President Vladimir Putin announce di military action.

Many pipo for Kyiv don rush to underground metro stations to take shelter. Odas don board buses to run from di city, queues dey of cars wey dey try to get out.

Crowds for metro station for Kyiv as air raid sirens ring out across di city. Many pipo dey carry bags and suitcases

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Crowds for metro station for Kyiv as air raid sirens ring out across di city. Many pipo dey carry bags and suitcases
One papa dey pet im son as his family take refuge for metro station
Wetin we call dis foto, One papa dey pet im son as his family take refuge for metro station
Girls dey on dia phones, dem take shelter inside di underground station

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Girls dey on dia phones, dem take shelter inside di underground station
Families dey troop in to di metro station on Thursday morning

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Families dey troop in to di metro station on Thursday morning