Ukraine Russia tension: Vladimir Putin TV speech highlight and how world leaders react
Russian President Vladimir Putin don recognise breakaway rebel regions for Ukraine east as independent states, dis one mean say e don end di peace ok on dat mata.
Di self-declared pipo republics of Donetsk and Luhansk na home to Russia-backed rebels wey don dey fight Ukrainian forces since 2014.
Russian troops don dey ordered to perform one kain "peacekeeping functions" for both regions.
Ukraine president accuse Russia of violating dia sovereignty.
Inside one late-night TV address to di nation, President Volodymyr Zelensky say Ukraine bin wan peace, but declare say "We no dey afraid" and "we no go give anytin away to anyone". Kyiv now need "clear and effective actions of support" from im international partners.
"E dey very important to see now who our real friend and partner be, and who go continue to use words only to dey put fear for di Russian Federation body," e add.
Western powers fear say as Mr Putin recognise di areas wey rebel dey hold, e fit lead to Russian troops to officially enta Ukraine east.
In recent years, dem don give out plenti Russian passports to pipo for Donetsk and Luhansk, and Western allies fear say Russia fit now move military units enta under di tok of protecting dia citizens.
End of Di one wey oda users dey read well well
Speaking inside one one-hour-long address immediately afta Monday announcement, Mr Putin say na Soviet Russia bin "create" modern Ukraine, e bin dey refer to di kontri as "ancient Russian lands".
E refer to Russia say dem "rob" dem during di collapse of di Soviet Union for 1991, e accuse Ukraine of being a "US colony" wey goment "wey no get say" dey run, and allege say pipo dey suffer under di current leadership. E paint di 2014 protests wey comot Ukraine pro-Russia leader to be coup.
How world leaders react to Putin tok and action
US quickly condemn Mr Putin move, and President Joe Biden sign executive order wey stop new investment, trade and financing by Americans for di breakaway regions. Di White House say di measures dey separate to di wider Western sanctions wey dey ready to go "if Russia further invade Ukraine".
UK Prime Minister Boris Johnson say Russia actions amount to "violation of di sovereignty and integrity of Ukraine" say e break international law. E say na "very bad omen and very dark sign". Foreign Secretary Liz Truss say di UK go announce new sanctions on Russiaon Tuesday.
EU pledge to "react with unity, firmness and with determination in solidarity with Ukraine".
Australia Prime Minister Scott Morrison reject di suggestion say Russia troops go get a peacekeeping brief, e tell reporters: "E dey unacceptable, e dey unprovoked, e dey unwarranted ... some suggestion say dem be peacekeeping na nonsense."
Di move by Vladimir Putin don deepen di ongoing crisis for Ukraine, wey dey surrounded by more dan 150,000 Russian troops for im borders. Russia don deny say dem plan to invade, but US believe say attack go happun.
Wetin Russia want wit Ukraine?
Russia seize Crimea for 2014 as e argue say e get historic claim to am. Ukraine be part of di Soviet Union wey collapse for December 1991 and Oga Putin say na di "disintegration of historical Russia".
Clue to how President Putin dey reason Ukraine dey inside one lengthy piece e tok last year wen e call Russians and Ukrainians "one nation". E say Ukraine current leaders dey run "anti-Russian project".
Russia also dey vex say one 2015 Minsk peace deal for eastern Ukraine neva dey fulfilled.
Arrangements neva still dey ground for for independently monitored elections for di separatist regions and Russia don deny accuse say dem get hand for di lingering conflict.
Russia don deny say dem dey plan any invasion but dem don seize di Ukrainian territory before and dem get an estimate number of 100,000 sojas dem send go near Ukraine borders.
Russia for a long time don resist Ukraine move to join body wit European institutions, and Nato in particular.












