Uttar Pradesh: 13 pipo die afta dem fall inside well for Kushinagar India

Wia dis foto come from, ANI
At least 13 pipo don die afta dem fall inside one well during one wedding ceremony for di northern Indian state of Uttar Pradesh.
Police say di victims - all women and children - bin siddon ontop one metal slab wey cover di well wen e collapse under dia weight.
Two more pipo injure for di accident, wey hapun for Kushinagar district.
Prime Minister Narendra Modi call di deaths "heart-wrenching".
Di tragedy happun on Wednesday evening during di traditional "haldi" ceremony, wia relatives dey apply turmeric paste to di face of di bride and groom as sometin to mark prosperity.
Wen di slab break, oda guests bin run to rescue di victims and take dem to a nearby hospital. While dem declare 11 pipo dead immediately, two others die later during treatment, police tok.
Uttar Pradesh chief minister Yogi Adityanath do ask district authorities to assist di families of di victims.









