Couple for Anambra state wey die few months apart from each oda not long afta dem marry, go dey buried togeda

Chukwuemeka and Chinenye

Wia dis foto come from, Mary Odunukwe

One newly married couple for Anambra state wey die months apart before dia church wedding go dey buried togreda.

27 years old Chukwuemeka Odunukwe and im 26 years old wife, Chinenye die for 2021, few months apart from each oda.

Di couple bin dey plan to do dia 'white wedding' afta dem just finish dia traditional marriage wen di sad incident happun. Dem bin never even begin live well as husband and wife before di incidents happun.

Di young couple wey hail from Anambra state die leaving dia one year old pikin behind.

Di incident happen for Nnobi, Idemili South for Anambra state. Dia death na one wey shock pipo around dem, di tori also circulate for some social media platforms.

Di burial of two young couple wey die few months afta dia traditional marriage go finally happen several months afta dia death.

Chukwuemeka and Chinenye

Wia dis foto come from, Mary Odunukwe

'Hiccup wey no gree stop'

Mary Odunukwe, a middle age woman for interview with BBC Pidgin say her pikin bin dey do business for Onitsha, di commercial city of Anambra state Southeast Nigeria wen e begin get hiccup.

She say her son neva get dat kain sickness before and wen e start, dem tink say na because e no dey take enough water.

Mary say di hiccup no too bad because e no stop 'Emeka' from doing wetin e dey do.

Emeka mama say di hiccup suddenly dey worse afta her son marry Chinenye.

She say, "wen di hiccup come dey very bad, we carry am go different hospital but no improvement until we decide to use local means.

Na still on top dat mata we dey wen my pikin die for February last year. We get to bury am immediately sake of how im take die. Wetin we do na to put am for ground like dat." Emeka mama tok.

Chukwuemeka and Chinenye

Wia dis foto come from, Mary Odunukwe

Chinenye heart break wen my son die - Chukwuemeka mama

Madam Mary Odunukwe say she get four children and na Chukwuemeka be di first child.

According to Emeka mama, Chukwuemeka marry Chineye for August 2020 and e die for February, 2021 - di wife die for November of di same year.

She say di death of her son break Chinenye heart well-well wey be say di young woman enter depression.

"My daughter in law die afta she complain of headache nine months afta my son die." she tok.

Mary say, "how pesin go take get headache continuously for two weeks none stop?"

Emeka and Chinenye

Wia dis foto come from, Mary Odunukwe

Di tradition and burial

Di family no do autopsy to know di exact cause of di deaths and dem no also report di mata to police.

Madam Odunukwe say she don leave everi tin to God because she no get power to know wetin cause di deaths for her family.

Since di incidents last year, dem neva bury di young woman - though dem don bury Chukwuemeka wey first die.

Di family go do di final burial rites of di young couple for February 2022.

"We bury my son because of how e take die but we no perform any burial rite for am. We bin dey find money to take solve many problems.

"Now wey we wan bury di wife, we go do dia final burial rites togeda." She tok.