Valentine's day messages: 'I be Igbo, she be Yoruba but I no fit imagine life without her'

Wetin we call dis Video, ‘I no fit imagine myself wit any oda pesin’

Dis na di love tori of Oluyemisi Dada and Godwin Chukwueze wey totori pipo.

Yemisi bin air Godwin messages for her Facebook DM from 2012 to 2020 before she finally respond one day.

Yemisi wey be from di Yoruba speaking tribe of Nigeria and Godwin wey be Igbo tok about dia tori and challenge dem overcome to be togeda.