New born baby dey discovered inside toilet dustbin for Mauritius plane for Madagascar

Airport staff for Mauritius don find one new-born baby boy wey dey abandone inside di dustbin of one plane toilet.
Di woman wey dem suspect say born di pikin on di flight na one 20-year-old woman from Madagascar and she don dey arrested.
Di Air Mauritius plane wey land Madagascar, land for Sir Seewoosagur Ramgoolam International Airport on 1 January.
Airport officers bin discover am wen dem screen di plane for routine customs check.
Di officers bin notice blood-stained toilet paper, and rush di baby to a public hospital for treatment.
Di airport police also kwesion passengers.
Di woman wey dem suspect say di mama bin initially deny say di boy na her pikin.
But dem make her undergo medical examination wey confam say she just born.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dem put her under police surveillance for di hospital. Both she and di baby dey okay.
Di Malagasy woman wey land Mauritius on a two-year work permit go dey kwesioned afta her release from di hospital and go dey charged wit abandoning a newborn.
Why di mata dey of concern
New born baby immune system no strong kakaraka - Dis one mean say di pikin no go fit fight of bacteria or viruses very well.
And wen new babies no receive di adequate care dem suppose get wen dem born dem, if fit expose dem to different infections and diseases.
Caring for new pikin na big responsibility as dem need constant care.
Di baby go need warmth, safety, food, immunization, bathing and medical care .
Abandonment of new born baby dey happun on a regular across Nigeria, Africa and oda parts of di world.
In many cases e fit be case of unwanted pregnancy or hardship.















