Bashir Tofa: MKO Abiola opponent for June 12 1993 presidential election wey die for Kano don dey laid to rest

Dem don bury former Presidential candidate Bashir Tofa wey die at di age of 74.
Dem bury am according to Islamic rights hours afta e die on Monday, 3 January, 2021 - di funeral prayers hold for im house for Gandul Albasa area of Kano.
Emir of Kano Aminu Ado Bayero and hundreds of oda pipo bin gada for for di house wia dem hold di prayers.
Dem later bury Tofa for one cemetery for Kano.

Di former Nigerian presidential candidate Alhaji Bashir Othman Tofa die on Monday morning for Malam Aminu Kano Hospital.
Some pipo wey dey close to am say di politician bin dey sick.
Biography: Who be Bashir Tofa?

Wia dis foto come from, Other
Dem born am for Kano on June 20, 1947.
Tofa go school for both Nigeria and the United Kingdom.
E enta politics for 1976 and by 1977 e become councillor for Dawakin Tofa Local Government Area in 1977.
Since den, im don hold different political positions including Secretary of National Party of Nigeria (NPN) Kano State.
Bashir Othman Tofa run for president of Nigeria under National Republican Convention (NRC) for di 1993 presidential election against di late Moshood MKO Abiola on June 12.
Abiola wey contest as candidate of Social Democratic Party (SDP) win Tofa for di election - di military goment of General Ibrahim Babangida no gree declare Abiola winner of di election.
Until im death, Bashir Tofa na chairman of the Kano State Council of Elders.
More fotos from Tofa burial










