BBC 100 Women 2021: Who be di 100 Women wey di BBC chose for di year (and which ones dey from Africa)

Di BBC don reveal im list of 100 inspiring and influential women from around di world for 2021.

Dis year 100 Women dey highlight di ones wey dey hit di 'reset' - women wey dey play dia part to reinvent our society, our culture and our world.

Among pipo wey dey di list be Malala Yousafzai, di youngest ever Nobel Peace Prize laureate, Samoa first female prime minister Fiamē Naomi Mata'afa, Prof Heidi J Larson, wey be di Vaccine Confidence Project, and acclaimed author Chimamanda Ngozi Adichie.

Women from Afghanistan make up half of dis year list, some of dem use fake name and foto no dey for dia own safety.

Di resurgence of di Taliban for August 2021 don change di lives of millions of Afghans - as dem don ban girls to receive secondary education, dem dey disband di ministry for women's affairs, and dem don tell women in many cases make dem no return to work. Dis year list torchlight di scope of dia bravery and dia achievements as dem dey reset dia lives.

How dem choose di 100 Women?

Di BBC 100 Women team bin do shortlist based on names dem gada plus di ones wey di BBC network of World Service languages teams suggest.

We bin dey look for candidates wey make headlines or influenced important stories ova di past 12 months, plus di ones wey get inspiring stories to tell, achieve something significant or influence dia society for way wey fit no make news.

Dem we bin evaluate di list of names based on dis year theme - women who dey hit 'reset', wey dey play dia part to reinvent our world afta di global pandemic has forced so many of us to reevaluate dia way we dey live.

We bin also measure regional representation and due impartiality, before dem chose di final names.

Dis year BBC 100 Women make di unprecedented decision to devote half of di list to women from one kontri: Afghanistan.

We bin wan use di opportunity to highlight how many of dis women don disappear from different parts of public life, and share di voices of di ones wey dem dey silence or di ones wey be part of a new Afghan diaspora.

On 3 December, di Taliban bin issue decree for di name of dia supreme leader as dem instruct ministries "to take serious action" on women rights.

Di decree set out rules wey govern marriage and property for women, and say dem no go force women into marriage and make nobodi look dem like "property".

But dem don criticize di declaration say efail to mention girl secondary education and women's reduced rights to employment.

Some of di Afghan women on di list dey anonymous to protect dem and dia families, wit dia consent and following all BBC Editorial Policy and safety guidelines.

Credits

Produced and edited by Valeria Perasso, Amelia Butterly, Lara Owen, Georgina Pearce, Kawoon Khamoosh, Haniya Ali, Mark Shea. BBC 100 Women editor: Claire Williams. Production by Paul Sargeant, Philippa Joy, Ana Lucía González. Development by Ayu Widyaningsih Idjaja, Alexander Ivanov. Design by Debie Loizou, Zoe Bartholemew. Illustrations by Jilla Dastmalchi.

Photo copyrights: Fadil Berisha, Gerwin Polu/Talamua Media, Gregg DeGuire/Getty Images, Netflix, Manny Jefferson, University College London (UCL), Zuno Photography, Brian Mwando, S.H. Raihan, CAMGEW, Ferhat Elik, Chloé Desnoyers, Reuters, Boudewijn Bollmann, Imran Karim Khattak/RedOn Films, Patrick Dowse, Kate Warren, Sherridon Poyer, Fondo Semillas, Magnificent Lenses Limited, Darcy Hemley, Ray Ryan Photography Tuam, Carla Policella/Ministry of Women, Gender and Diversity (Argentina), Matías Salazar, Acumen Pictures, Mercia Windwaai, Carlos Orsi/Questão de Ciência, Yuriy Ogarkov, Setiz/@setiz, Made Antarawan, Peter Hurley, Jason Bell, University of Sheffield Hallam, Caroline Mardok, Emad Mankusa, David M. Benett/Getty, East West Institute Flickr Gallery, Rashed Lovaan, Abdullah Rafiq, RFH, Jenny Lewis, Ram Parkash Studio, Oslo Freedom Forum, Kiana Hayeri/Malala Fund, Fatima Hasani, Nasrin Raofi, Mohammad Anwar Danishyar, Sophie Sheinwald, Payez Jahanbeen, James Batten.

Wetin be di 100 Women?

BBC 100 Women dey name 100 influential and inspirational women around di world evri year. We dey create documentaries, features and interviews about dia lives - story wey dey put women for di centre.

Follow BBC 100 Women on Instagram, Facebook and Twitter. Join di conversation use #BBC100Women.