BBNaija Cross snapchat nude video: Cross, Angel, Tiwa Savage, Nengi, celebs nude dey rise?

Wia dis foto come from, Other
Cross, Tiwa, Angel, Etinosa, Nengi alleged nude or sex tapes dey make some wonder weda nudity dey rise for Nigerian celebrities domot?
BBNaija Cross [di 30-year old wey im full name na Cross Ikechukwu Okonkwo] snapchat nude video na di latest.
But di former Big brother Naija reality housemate, Cross say na by mistake im post nude video on top Snapchat.
However, dis latest nude video dey make some wonder weda nudity dey rise for Nigerian celebrities domot?

Wia dis foto come from, Instagram/Crossdaboss
Just di oda day, plenty tok about Nigerian singer Tiwa Savage and one alleged sex tape video of her na full pipo mouth.
Di "Somebody's son" singer reveal say pesin bin dey blackmail am for one clip wey she bin do with her bobo.
Sadly, pipo don cari eye see dis sex tape of Nigerian singer wey she publicly own up to.
Within di last two years, many Naija celebs wey rise to fame dey face nude tape blackmail or misbehaviour.
End of Di one wey oda users dey read well well
Nigerians and fans of dis celebs dey reason why dem dey like to dey record sex tapes.
Apart from Tiwa Savage and Cross of BBNaija season six, sex tapes of oda celebs don go viral before-before.
From 2019 till date alone, e don get cases of leaked naked pictures or video of Naija celebs wey go viral for social media.
Angel BBNaija ex-housemate nude for live TV

Wia dis foto come from, Instagram@angeljbsmith
Angel Smith wey make top five housemates for BBNaija season six edition bin flash her private part for live TV during di 2021 reality show.
She later explain to BBC Pidgin 'why she no dey place her value on pesin wey see her bodi' - Click here to watch di full interview.
But dat one general plenty mixed reaction.
Etinosa on MC Galaxy IG video
Wen dis one happun for March 2019, she admit say she bin dey high wen e happun.
Etinosa wen she explain real reason why she naked for MC Galaxy Instagram live video, admit wrong.
She say she bin tink say she bin dey catch fun but regret di act.

Wia dis foto come from, Nengiofficial/Twitter
BBNaija Nengi alleged sex tape
One alleged 'old sex tape' of BBNaija Lockdown housemate "Nengi" go viral lately on social media for August 2021.
Although di season five BBNaija celeb Nengi Hampson neva tok peem for di mata.
Unconfirmed tori be say na her ex-boyfriend wey social media users describe as "Naughty Kay" na im leak di video.
Di sex tape still be conversation around town but e dey yet to be confirmed.
And weda na tru or lie, e fit also dey cause damage for di celeb wey do get appointment as Senior Special Assistant to di Bayelsa State goment.
Tacha

Wia dis foto come from, @Symply_Tacha/Twitter
One of di most controversial Big Brother Naija reality TV show housemates, Tacha bin receive blackmail for 2020 for nude pictures wey she say bin dey edited.
She come on Twitter to post di email wey she bin get.
Dem wan use 'fake naked foto' blackmail me, Tacha tok.
Toke Makinwa

Wia dis foto come from, Instagram/Toke Makinwa
For April 2020, media personality Toke Makinwa bin face blackmail too by pipo wey tok say dem go post her nudes except she pay dem.
For Instagram post wey she later comot, she post di picture and tok say di one wey dem bin dey blackmail her with dey photo shopped.
Salawa Abeni

Wia dis foto come from, Instagram/@officialsalawaabeni
For April 2020, Nigerian singer, Salawa Abeni bin burst pipo head afta she say pesin bin dey blackmail am.
Di pesin say dem go post her naked pictures if she no give them money.
For di Instagram post she reveal say she bin either dey for hospital or with her partner when dem take di pictures.
But she say she no go let anyone bully her as she post di pictures herself.
Later, police come arrest di alleged blackmailer wey bin dey di age of 19.
Small Doctor

Wia dis foto come from, Instagram/@smalldoctor
For 2017, video comot of di Mosquito Killer singer dey masturbate for inside Snapchat.
Tori pipo tok say im later comot to reveal say na hack dem hack im phone post am.
Celebs nude dey rise?
From wetin we don torchlight, e be like say true-true dis mata of celebs nude dey increase by di way.
Some dey do am by demsef but later regret dia actions, odas na blackmailers go want to expose am.
But many of di times e be like say na di hunger to catch fun or spice up di kain fun dem dey get dem make dis tape or foto.
Di long run effect many a times fit be as bad as depression for di pesin wey dey exposed.
Again di coming to be of different social media fun apps fit also don be a fuelling factor.













