Covid-19: Vietnam court sama one man five years in prison for spreading coronavirus

Le Van Tri

Wia dis foto come from, Thanh Nien

Wetin we call dis foto, Court judge say Le Van Tri dey guilty of transmitting dangerous infectious diseases

One Vietnam man don chop fives year for prison for disobeying Covid-19 rules and spreading di virus.

Court find Le Van Tri guilty of “transmitting dangerous infectious disease” to eight pipo, wey one of dem eventually die.

Until recently, Vietnam don successfully keep Covid out wit di tight restrictions wey di kontri get.

But di number of infections rise for June, afta Delta Variant cause outbreak.

Wit di outbreak of di Delta variant, di kontri see more dan 530,000 cases wit more dan 13,300 deaths, most of di death happun last few months.

Na fo Ho Chi Minh City dem find many of dis infections.

Early for July, Tri wey dey 28 years bin travel for motorcycle go Ho Chi Minh for im home town province Ca Mau, for south of di kontri.

For Ca Mau, dem discover say Tri bin lie for im health declaration form wey dem ask am about im recent travel history. Im also no gree comply wit isolation rules.

At dat time, local authorities bin don make am compulsory for any pesin wey come from anoda province come Ca Mau province, must to immediately isolate imsef for 21 day.

Tri later test positive for Covid. Dem also discover say im don give am to members of im family plus staff of di welfare centre wey im visit.

Tri chop sentence afta one day trial, and dem also fine am di equivalent of $880.