Makers of Lysol and Dettol disinfectants don give strong warning against Trump suggestion for coronavirus

Presentational white space
Read am in 4 mins

One leading disinfectant producer don give strong warning say make pipo no use dia products ontop human body afta US presido Donald Trump suggest say dem fit use am cure coronavirus.

Reckitt Benckiser, wey own Lysol and Dettol, say notin go make anyone swallow or injest dia products.

President Trump dey face yabing about im at one briefing for Thursday.

Disinfectants na dangerous substances wey fit cause harm if pesin eat am.

Even make pesin dey expose to di substance physically fit dey dangerous to skin, eyes and respiratory system.

Doctors don dey criticise oga Trump on top im comment and e don generate plenty reaction online.

Di comment don cause hundreds of thousands of comments and even ma well-known cleaning brands todey trend on top social media.

Reckitt Benckiser, wey also get di brands Vanish and Cillit Bang, say make dem no use im products "through injection, swallow or any oda route".

"Use our disinfectant and hygiene products as we put for usage guidelines. Abeg read di label and safety information," di company tok for statement.

US shop shelves selling Clorox, Lysol and other cleaning brands

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Disinfectants na dangerous substances wey fit cause harm if pesin eat am.

Wetin President Trump tok?

During di White House Coronavirus Task Force briefing for Thursday, one official bin present di result of di research wey US goment bin do wey show say coronavirus dey weak if e dey exposed to sunlight and heat.

Di study also show say bleach fit kill di virus wen e dey for saliva or water wey dey comot from nose (respiratory fluids) within 5 minutes. Isopropyl alcohol wey be spirit go even kill di virus quick-quick pass.

Mr Trump dey reason if e go dey possible to use "tremendous ultraviolet" or light wey strong well-well inside body as treatment for di virus.

"And then I see di disinfectant wia e go knock am out in a minute. One minute," Im tok. "And e get a way we fit do something like dat, by injection inside or almost a cleaning?

"Because you see ehn e get inside di lungs and go do very well on dem, so e go dey interesting to check dat," im tok.

Wetin we call dis Video, Top US doctor says heat and light are not a treatment for Covid-19

Im comments don catch fire for social media platforms like Twitter and Reddit.

Many compare im idea to one dangerous viral trend wey happun for 2018 wia pipo bin Tide laundry detergent pods.

Lysol, wey be one of America best known cleaning brands, don see tweets of dia name for at least 125,000 times since di White House news conference.

Owners Reckitt Benckiser say dem issue dia statement on Friday "due to recent speculation and social media activity".

Presentational white space

Wetin medical tok ontop dis mata?

Doctors don sama warning say wetin President Trump dey suggest so, di result fit dey very bad.

"Dis idea of make pipo begin inject products wey dem carry dey clean house or make pipo begin swallow cleansing products no be here and again e dey dangerous"

"To begin inhale chlorine bleach na di worst tin wey fit happun to di lungs," Pulmonologist John Balmes tell Bloomberg News.

"Di airway and lungs no suppose dey exposed to aerosol, talk less of disinfectant.

Dis no be di first time wey Mr Trump medical advice dey cause kasala and disagreement.

Before now, im bin don hype one malaria melecine, hydroxychloroquin, say e fit cure Covid- 19 even though no clinical evidence dey to support di claim and experts say di melecine even fit cause serious problem, if dem try am.

Skip Facebook post

Content is not available

View content on FacebookDe external site no concern BBC.

End of Facebook post

Poisoning and death risks

BBC health reporter Rachel Schraer, investigate di mata

You fit use disinfectant kill virus for surface. E dey very good to clean anytin wey you touch with products wey get anti-bacteria - for example products wey get plenty alcohol content inside.

Evidence also dey say virus wey dey surface dey quick die if dem dey face sun directly. But wetin we know sabi na for how long we go take expose dem to sun wey we go get result. Di best tin and di safest tin na still to dey wash hands and surfaces, and stop to dey touch your face.

One of di ways to catch Covid- 19 na if pesin wey get di disease sneeze or cough for wia pipo dey. Di virus go quickly begin multiply come spread till e reach di lungs.

No be only poison or di fact say pesin fit die na di only risk wey dey if pesin swallow or inject disinfectant, e possible say e no go even work.

And di same time, if di virus don settle for body wella, no amount of UV light for di skin go make any difference.

And since UV radiation dey damage di skin, to take am kill di virus wey dey inside body na im go worse pass.

Earlier this week, di US Centers for Disease Control and Prevention warn Americans say make dem dey careful of how dem dey buy cleaning products as di demand for dis products high well-well during dis pandemic.

"Di fone calls wey poison centres bin receive de very high for di beginning of March 2020 sake of exposure to both cleaners and disinfectants," di agency weekly morbidity and mortality report.

Di US Food and Drug Administration don also sama warning say make pipo no drink disinfectants, as dos pipo wey dey claim say dem get products wey contain bleach and fit treat everytin from autism to Aids and hepatitis, dey lie give dem.

Last week, one federal judge bin secure temporary injunction against one organisation, Genesis II Church of Health and Healing, wey sell one of these products say e fit cure coronavirus.

BBC Pidgin Covid 19 graphics
BBC Pidgin Coronavirus slice