Afghanistan withdrawal: President Biden say US army fit remain pass August 31 deadline
American President Joe Biden don tok say US troops go fit stay Afghanistan pass di 31 August deadline.
Americans [US Army] bin set next Tuesday 31 as di last date to comot alias evacuate from Afghan palava.
Images of palava and kasala dey burst upandan for di Kabul airport wia foreign powers dey struggle to move dia pipo.
President Biden also defend di way im handle Afghanistan, afta di Taliban use di fact say America bin dey comot to take ova power.
E tell American tori pipo ABC News say im no think say im make mistake.
![Afghanistan withdrawal [Afghan President Ashraf Ghani]: President Biden say US army fit remain pass August 31 deadline](https://ichef.bbci.co.uk/ace/ws/640/cpsprodpb/10CB3/production/_120078786_afghanistanwithdrawalpresidentbidensayusarmyfitremainpassaugust31deadline.jpg.webp)
Wia dis foto come from, Unknown
Meanwhile Taliban say dem no go change mouth about dia promise to allow foreigners leave Kabul Airport.
One Taliban official tell tori pipo Reuters dem dey do every every to prevent kasala for di airport.
For Afghanistan, attempts to evacuate don create tension between Afghans, foreigners and Taliban.
End of Di one wey oda users dey read well well

Wia dis foto come from, Reuters
Oga Biden bin want make US forces comot by di end of di month but thousands of American citizens still dey hooked for inside di kontri.
Washington bin don promise to comot all di American citizens plus including di up 65,000 Afghans like di ones wey bin do translator work for US military.
As at now, ova 5,000 US troops dey on ground to assist with Operations for Kabul airport but Taliban get checkpoints around dia.
Taliban dey block Afghans make dem no enta airport without travel document, and even those wey get dey hear wiin.
Dem ask oga Biden for interview, about di video wey go viral wey show Afghans dey fall from American military plane wey don take off for Kabul.
E say, "wetin I bin tink be say we need to move forward so we go fit take ova dat airport, and na wetin we do."

Wia dis foto come from, Khairullah Hotak/EVN
Biden no tink say Taliban don change
Oga Biden bin formally say e dey "highly unlikely" say Taliban go take back power and also bin tok for April say im go withdraw Americans safely and orderly.
But everything don enta mud now and Biden no dey claim say intelligence reports bin tok say di takeover go only fit happun for di end of di year.
When dem ask am if Taliban don change, di American President say no.
Dis na as di hard-line Islamists dey try to show say dem dey moderate but tori dey say dem dey use violence to calm protests and don stop women to go work.












