Taliban ask Afghan pipo to leave di airport

Wia dis foto come from, AFP
Taliban don ask di crowd of Afghanistan pipo wey dey wait outside Kabul international airport wit di hope of leaving di kontri make dem go home.
Di Taliban say dem no wan hurt anybody, one day afta di fighters open fire on protesters kill three.
Di United States and oda pwers from di West still dey evacuate dia kontri pipo and some of dia Afghanistan staff from di kontri on Afghan independence day.
Generally, Kabul dey calm since Taliban forces enta di kontri capital on Sunday, di airport dey upside down as pipo dey try rush out of di kontri.
Twelve pipo don die inside and around di airport since Sunday, according to wetin one NATO and Taliban officials tell tori pipo Reuters.
So far, about 8,000 pipo don fly comot from di kontri since Sunday. US military dey in charge of di airport while Taliban fighters dey patrol outside di airport walls and fence perimeter.
Meanwhile, US President Joe Biden don tok say US troops fit stay for Afghanistan pass di withdrawal deadline as armed Taliban fighters dey prevent desperate pipo wey wan leave di kontri from reaching Kabul airport.
Oga Biden want US military to leave di kontri by di end of dis month, but up to 15,000 US citizens still dey hang inside di kontri.
End of Di one wey oda users dey read well well
Foreign goment dey try hurry up di evacuation of dia kontri men plus Afghan pipo wey bin work for dem.
America don pledge to cari all di remaining American citizens plus 50 to 65,000 Afghan pipo - like former translators for di US military - comot from Afghanistan.














