Taliban: Afghanistan airport don dey US troops hand as Afghans dey try run from Taliban rule

Wia dis foto come from, AFP
Pipo dey run comot from Kabul di capital of Afghanistan as di Taliban don takeover di city.
Na katakata for di Kabul airport as thousands of pipo try to fly comot from Afghanistan before di Taliban go fully establish for di kontri.
Di confusion everywia for di airport force US troops to fire warning shots for air to prevent di crowd of desperate citizens from running into planes, one official tell tori pipo Reuters.
Di official say: “Di crowd bin dey out of control, di firing na only to reduce tension.”
US military don secure di site and dem don take over air traffic control to evacuate American and allied staff on military planes.
But commercial flights dey suspended, as hundreds of Afghans and other foreign nationals dey stranded.
Afghanistan Civil Aviation Authorities cancel all flights out of di Kabul international airport.
Aside from pipo wey dey try fly out of di kontri, many odas enta road and traffic jam also full everywia as pipo dey try drive out of Kabul wit dia families.
End of Di one wey oda users dey read well well
As some of di pipo dey run comot from Kabul and out of Afghanistan, odas according to one Afghan Member of Parliament, Farzana Elham, “dey hide inside dia house.”
Earlier, pipo bin gada for banks hoping to withdraw dia money as dem dey fear say dem fit lose dia savings.
Di militants also release prisoners for Kabul prison wey don call for peaceful transition of power.
Some districts for Kabul don already fall into di hand of di Talibans.
All di oda major cities for di kontri don already fall to di Taliban and dem don almost completely take over di kontri.
Afghanistan and oda times militia take over presidential palace

Wia dis foto come from, Getty Images
E no longer be news say Taliban no only dey in control of Kabul wey be capital of Afghanistan but dem don also seize control of di presidential palace on Sunday.
Afghan presido Ashraf Ghani leave di kontri as Taliban dey approach Kabul wey throw di kontri into limbo.
See di oda times wey militias take over presidential palace.
Yemen presidential palace - Dis one happun for 2015 as fight bin dey go on between Houthi fighters and di goment over control.
According to BBC report on di 3rd of April, di Houthi militia push through di city with armoured tanks killing 44 pipo before dem take control of di palace.
Di presido Abdallah Saleh later run go Saudi Arabia for im safety.
Central African Republic - Dis one happun for 2013 as rebels take control of di presidential palace but presido Francois Bozize don already run comot for di palace at di time.
According to BBC report heavy fighting bin happun between di seleke rebels and goment forces on di 24th of March before di rebels take control.
Na later tori pipo confam say presido Bozize and im family escape go Congo.











