Rihanna net worth: Robyn Fenty become di richest Female musician for World

Rihanna

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 1 mins

Forbes don call Rihanna say she be di richest female musician for di world as dem announce say she don join di billionaires club.

She also be di second richest female entertainer after Oprah Winfrey.

Di Singer and Fashion oga don make net worth wey reach $1.7bn and most of that money dey come from her Fenty Beauty ($1.4 bn) and her underwear line, Savage x Fenty ($270 million).

She bin start her Fenty Beauty company for 2017.

Di Barbados artiste wey her mama name Robyn Fenty also make money from all di feem and music wey she don do overtime.

Dis na as di Love On The Brain singer neva release any new music since her ANTI album for 2016.

Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Instagram post

Forbes mention say she bin use her celebrity status for inside social media to take build her brand and na di most successful beauty business pesin to run am.

For 2018, tori be say she make more money for her beauty company than Kylie Jenner Kylie Cosmetics and Kim Kardashian West's KKW Beauty.

All her brands for both make up and underwear (wey Oyinbo dey call lingerie), she dey always advertise based on inclusion.

Forbes estimate say her Fenty Beauty wey she own 50% of dey worth $2.8 billion and at di rate wey e dey go e go dey continue to rise.