You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
NTA road accident: Accident for Port Harcourt lead to death of five for traffic collision
Five pipo die for fatal accident wey happen for midnight breaking Saturday along di NTA Mgbuoba Road for Port Harcourt.
Di accident occur around 1am, just days afta Rivers State goment lift di night time curfew.
Police confam di incident to BBC Pidgin on Saturday.
'Dem don deposit di deadi bodi of all five of dem for mortuary as investigation don begin.'
Na wetin Nnamdi Omoni, di tok tok pesinof Rivers Rivers State Police Command tell BBC.
Eye witnesses say di motor wey carry di five pipo, two boys and three girls, go jam one truck wey pack along di road.
Na sewage disposal tanker truck dia car jam and all of dem die on di spot, witnesses add.
Tori be say di victims wey be university students bin dey return from night club wen di accident happen, but police never confam who dem be.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dis dey happen barely three days after di Rivers State goment lift di Statewide night time curfew wey bin last for over two months.
Some residents around wia di accident happun claim say e fit be as a result of over speeding.
Di accident cause heavy traffic gridlock along di NTA/Choba road on Saturday.