Philippines military plane crash wey carry soldiers kill at least 50

Wia dis foto come from, Reuters/Bogs Muhajiran
At least 50 pipo don die for military plane crash wey happun for southern Philippines, but 40 bin come out alive from di burning wreckage.
Di military transport aircraft bin dey carry 98 pipo, mostly soldiers, wen e overshoot di runway for Jolo airport wey dey Sulu province on Sunday.
Di soldiers bin dey among reinforcements wey dem send to fight Islamist militants such as di Abu Sayyaf group.
Di dead na mainly military personnel, but three civilians wey bin dey for ground also die, na so di defence ministry tok.
Five pipo bin dey initially listed as missing, but all passengers onboard now don dey accounted for.
Tok-tok pesin for di Armed Forces of Philippines tell news site ABS-CBN say dem dey look for di flight data recorder to find out exactly why di plane fit don crash.
Major Gen Edgard Arevalo tok say sign no dey say di plane bin come under any attack.

Wia dis foto come from, Reuters
Di plane, wey come down at 11:30 local time (03:30 GMT) few kilometres from di town of Jolo, bin dey carry troops from Cagayan de Oro, for di southern island of Mindanao.
End of Di one wey oda users dey read well well
"E miss di runway, as im try to regain power but e no make am," armed forces chief Gen Sobejana tell reporters.

Wia dis foto come from, Reuters
Inside statement from di regional military force, di Joint Task Force Sulu, tok say "dem bin see how a number of soldiers jump out of di aircraft before e hit di ground, na dis one save dem from di explosion wey di crash cause".
Dem no give details about how dem manage to get out of di plane or how their condition be afta di incident.
Many of those on board had only recently completed basic military training, AFP reports.

Wia dis foto come from, Philippines Department of National Defense
Di US bin handover di plane to di Philippines for January, e bin previously dey in service wit di US Air Force.
E bin be di first of two used Hercules to be delivered by di US under defence co-operation scheme.
Di aircraft first flew in 1988, according to Aviation Safety Network.












