Pastor Enoch Adeboye twitter and #TwitterBan Nigeria: Kumuyi, el Rufai, Makinde - VIPs wey still dey tweet
!["Pastor Adeboye twitter" on #TwitterBan Nigeria: [el Rufai, Kumuyi, Seyi Makinde tweet]s afta ban 'Twitter public policy'](https://ichef.bbci.co.uk/ace/ws/640/cpsprodpb/5F35/production/_118837342_pastoradeboyetwitterontwitterbannigeria-elrufaikumuyiseyimakindetweetsaftaban'twitterpublicpolicy'.png.webp)
Wia dis foto come from, Getty Images
Twitter ban inside Africa most populous nation don begin bite hard on brands and businesses wey get massive followers wit expected pushback.
Two influential Nigerian pastors Enoch Adeboye and William Kumuyi don disregard Nigeria suspension on di micro-blogging social media network..
Di General Overseer of di Redeemed Christian Church of God [RCCG] say to tweet dey part of dia human rights.
While di General Superintendent of Deeper Christian Life Ministry, tok say dia church dey tweet from different locations across five kontirs.
E dey safe at dis point to say Nigeria federal goment Twitter ban dey experience partial compliance among Nigerians.
But as tins be so Nigeria goment no wan hear anyting as far as dia 'no tweet' and prosecution order ontop Twitter ban policy dey concern.
Di chief Law officer for di kontri wey be di Attorney General of di federation and Minister of Justice Abubakar Malami further explain.
Malami on Saturday say di continuous use of Twitter by anybody, organization or group for Nigeria get implication.
End of Di one wey oda users dey read well well
Inside statement, Malami "direct di Director of Public Prosecution of di Federation [DPPF] to swing into action.
E order di DPPF to process di prosecution of violators of di Federal Government order on di De-activation of operations of Twitter for Nigeria."
But Nigerians still dey Tweet - infact some goment officials and agencies still dey use twitter.
Pastor Adeboye, Kumuyi, VIPs, goment officials still dey Tweet
!["Pastor Adeboye twitter" on #TwitterBan Nigeria: [el Rufai, Kumuyi, Seyi Makinde tweet]s afta ban 'Twitter public policy'](https://ichef.bbci.co.uk/ace/ws/640/cpsprodpb/AD55/production/_118837344_pastoradeboyetwitterontwitterbannigeria-elrufaikumuyiseyimakindetweetsaftaban'twitterpublicpolicy'.jpg.webp)
Wia dis foto come from, Getty Images
As at Monday 7 June 2021 some influential Nigerians including goment officials especially govnors still use di platform pass dia message.
Dis na afta federal goment make di pronouncement about Twitter ban on Friday
Di latest na di General overseer of The Redeemed Christian Church of God (RCCG) Pastor Enoch Adeboye wey say im church "dey for more dan 170 kontris.
Di tweets here dey in accordance to Article 19 of di UN universal declaration of Human Rights."
Oyo state govnor Seyi Makinde on Saturday post for Twitter say federal goment no do well to suspend di microblogging platform.
On Sunday Ondo state govnor Rotimi Akeredolu also use di im Twitter handle condemn di attack wey happen for Igangan Ibarapa Local goment area of Oyo state.
Kaduna state govnor Nasir El-Rufai also di platform retweet tori on Saturday.
!["Pastor Adeboye twitter" on #TwitterBan Nigeria: [el Rufai, Kumuyi, Seyi Makinde tweet]s afta ban 'Twitter public policy'](https://ichef.bbci.co.uk/ace/ws/640/cpsprodpb/D465/production/_118837345_pastoradeboyetwitterontwitterbannigeria-elrufaikumuyiseyimakindetweetsaftaban'twitterpublicpolicy'.png.webp)
NBC 'no tweet warning' - Federal Goment warn broadcast stations
Nigeria National Broadcasting Commission on Monday direct all broadcast stations for di kontri to suspend di usage of Twitter wit immediate effect.
Di commission direct broadcast stations to "de-install Twitter handles and stop dey use Twitter as a source (UGC) of information gathering for News and programmes presentation especially phone-in."
Acting Director-General of di NBC, Prof. Armstrong Idachaba, give dis directive inside statement e release on Monday wey e title: "Suspend Twitter handles."
FG summon envoys
!["Pastor Adeboye twitter" on #TwitterBan Nigeria: [el Rufai, Kumuyi, Seyi Makinde tweet]s afta ban 'Twitter public policy'](https://ichef.bbci.co.uk/ace/ws/640/cpsprodpb/11A29/production/_118833227_bbc.jpg.webp)
Di Minister of Foreign Affairs, Geoffrey Onyema invite foreign kontris for wetin im describe as "friendly" meeting over Nigeria decision to suspend twitter.
Ambassador of United States, Ireland, British Deputy High commissioner, Canadian High Commissioner to Nigeria, and delegation of European Union to Nigeria and ECOWAS insist say "free access to social media dey important and we dey happy say goment dey tok wit Twitter."
But afta di Oga Onyeama tell BBC Pidgin say Nigeria don give condition for Twitter to continue dia operation for di kontri.
"Sake of di security situation for di kontri and how pipo dey use Twitter to cause security katata for naija, need dey for Twitter to ensure responsible use of di platform," im tok.
#TwitterBan Nigeria background
Federal goment on Friday throw Nigerians off balance wen dem announce say Nigeria don suspend di use of Twitter for di kontri.
Nigeria presidency for statement wey Garba Shehu, Senior Special Assistant to di president sign later explain say:
"Plenty problems dey wit di social media platform for Nigeria, wia misinformation and fake news wey dem spread through am don get real world violent consequences. All di while, di company don escape accountability.
"Nevertheless, di removal of President Buhari tweet dey disappointing.
"Di censoring seem to base on misunderstanding of di challenges wey Nigeria dey face today."

Wia dis foto come from, Getty Images
'Twitter public policy' response
Twitter say Friday announcement from di Information Minister Lai Mohammed dey "deeply concerning".
"We dey investigate and go provide updates wen we know more." Di internet company, wey Jack Dorsey be oga, write for dia reply.
Earlier di global policy team of di social networking site, Twitter Public Policy [@Policy] tweet ontop di mata say:
"We dey deeply concerned by di blocking of Twitter in Nigeria. Access to di free and #OpenInternet na one very important alias essential human right in modern society.
"Twitter Public Policy add say dem go work to restore access for all those in Nigeria wey dey rely on Twitter to communicate and connect with di world.
Access to Twitter from Nigeria main phone providers don dey blocked, according to reports from Lagos and di capital, Abuja.














