You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Bitcoin price: Elon Musk Teslsa latest move on Cryptocurrency fall Bitcoin price
Tesla don stop to dey collect Bitcoin as money to buy dia cars.
Elon Musk, Tesla CEO announce for tweet say di reason na on top climate change issues wey e fit cause.
Dis bin cause Bitcoin to fall 10% afta di tweet and Tesla shares follow bow.
Dis na because dem dey make Bitcoin with high powered computers.
Na computers wey miners dey use compete with dem selves to solve hard mathematics puzzles.
So na plenti energy di computers dey take work and dem dey most time rely on electricity wey dem make from fossil fuel like coal.
Wen Tesla announce for March say dem go begin accept di cryptocurrency as payment, environmentalists and investors hala.
Dis fit be loss for di electric car maker. As for February, dem reveal say dem buy $1.5 bn of di crypto currency.
End of Di one wey oda users dey read well well
But oga Musk neva give up on crypto as di way.
For di statement e say; "Cryptocurrency na good idea... but we no fit to come at great cost to di environment."
Di 49-year-old businessman say di company no go sell any of dia Bitcoin.
And go start to dey use am for transaction as soon as di mining of di cryptocurrency begin use sustainable energy. E add.