You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Cybercrime for Africa: UK give £3 million for Ghna, Nigeria, Kenya to fight cybercrime
UK govment announce £3 million ($4.2m) funding to fight cybercrime for Africa.
Foreign Secretary, Dominic Raab talk say de UK dey make available £22 million.
Raab add say dem go take support cyber-security capacity building globally.
Five African countries which dey include Ghana, Nigeria den Kenya dey benefit from dis project.
Dem wan use de money strengthen systems to fight cybercrime den step up dema activities for Africa.
Experts talk say de continent get weak cyber-security systems.
According to INTERPOL about 30% of cybercrime prosecutions dey happen on de continent sake of different legal regimes.
De UK govment dey now help create central coordinating desk plus INTERPOL.
End of Di one wey oda users dey read well well
Na for Africans to fit use for joint operations.
INTERPOL reveal say de global economy go lose about $10 trillion to cybercrime by 2025.