Omagwa Ikwerre attack: Custom bury three of dia officers wey gunmen kill near Port Harcourt airport for Rivers

"Rivers State news": [Gunmen attack Police officer "murder" near Port Harcourt airport]

Wia dis foto come from, Other

Wetin we call dis foto, At least eight officers dey confirmed dead as a result of dis attack near Port Harcourt airport.

Customs don bury three of dia officers gunmen kill for Omagwa according to Islamic rites.

Di Nigerian Customs Service NCS don confam say dem don bury di three personnel wey gunmen kill for Customs checkpoint for Omagwa, Ikwerre local goment, Rivers State.

Di tok tok pesin for Zone C Customs Federal Operations Unit, Jerry Attah confam to BBC Pidgin say dem bury di three officers according to Islamic rites on Sunday for di Tipper Garage cemetery for Eleme, Rivers State.

Attah say after killing di men, di gunmen carry one AK47 rifle and two Toyota Hilux vans wey belong to di Customs service, come add say dem go do thorough investigation to find out di circumstances wey lead to di attack and di motive of di attackers.

Gunmen kill security officers for Port Harcourt

Gunmen don attack and kill security officers for one military checkpoint near Port Harcourt international airport for Rivers State.

Nigeria police confam di attack, wey happun along di Owerri/Port Harcourt airport road, to BBC Pidgin today Sunday 25 April.

At least eight officers dey confamed dead as a result of dis attack, according to police.

"I fit confam di attack on top security personnel along di Omagwa/Isiokpo/Elele Owerri road details still dey sketchy."

Nnamdi Omoni, di public relations officer of Rivers State Police Command tok.

Nigerian Customs Service officials dey among pipo wey di gunmen kill for dis attack, based on wetin BBC find out.

Dis dey happen just one day after gunmen burn part of Govnor Hope Uzodimma house for Imo state, where dem also kill some security personnel.

Di fresh killings take place for Isiokpo Community inside Ikwerre Local Government Area, wey be one hour drive from Port Harcourt.

Tori be say di unknown gunmen before killing dia victims bin invade and scatter one Military check point for Isiokpo.

Dem also destroy properties for di area wey dey within Omuagwa axis of Elele-Owerre road.

Pesin from di community wey see wetin happen tell tori pipo say di armed men use force enter di checkpoints.

Dem scatter di barricades, den burn di operational vehicles wey dey dia, di eyewitness add.

Police confam officers 'murder' for Ikwerre near Port Harcourt airport afta Imo attacks

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Three days before dis incident American goment update dia US travel advisory on Rivers State.

Meanwhile Rivers State Govnor Nyesom Wike don condemn di gunmen attack wey happun on Sunday.

Wike say im goment stand wit di security agencies and dey demand for di arrest of all di attackers.

E also send sorry messages to di families of those wey lose loved ones, adding say justification no dey for wetin just happun.

River State Police command don begin investigate di mata.

"Di Commissioner of Police don launch full scale Investigation into di dastardly attack with a view to arrest di perpetrators and bring dem to justice." oga Omoni add.

"Meanwhile, di area don dey calm with reinforced and increased joint patrols for di stretch of di road and oda areas for di State by di security agencies."

Three days before dis incident American goment update dia US travel advisory on Rivers State.

For di advisory dem warn dia citizens not to travel to any part of di oil rich state except Port Harcourt .

Rivers State wey be heart of south south region of Nigeria share boundaries with two south eastern states - Abia and Imo.

Fear dey say di unknown gunmen wey dey worry south eastern states fit carry dia wahala enter Rivers.