Port Harcourt Cult clash: Deaths for Rivers cult fight as US travel advisory okay PH
![[Cult clash in Port Harcourt]: "Deaths for Rivers State cult clash as 'US travel advisory' exempt Port Harcourt"](https://ichef.bbci.co.uk/ace/ws/640/cpsprodpb/11B1B/production/_118157427_-cultclashinportharcourtdeathsforriversstatecultclashas'ustraveladvisory'exemptportharcourt.jpg.webp)
Wia dis foto come from, Getty Images
At least three pesins don die after two rival cult groups clash for Port Harcourt, di same day US travel advisory on Rivers State exempt di oil rich city.
Police wey confam di cult clash between Icelanders and Dey-gbam cults say e happun around di railway axis of Diobu inside di state capital.
Locals tell BBC Pidgin say one suspected Iceland and three suspected Dey-gbam members die for di clash.
Three pipo die on di spot while dem rush anoda one go hospital sake of serious wound e get for im lower abdomen.
One eye witness wey no wan mention im name say "we dey here dey sell market di next thing wey we hear na kpo! Kpo!! Gunshot.
Dis pesin wey dey sell market near wia di incident happen tell BBC Pidgin say: "Evribodi take cover. Market just close.
Dis na around 2:30- 3pm yesterday. Three of dem die on di spot. Police don come carry dem go."
Police tok tok pesin Nnamdi Omoni say wen dem get report of di gun shootout, officers of Diobu Division mobilize go and dem arrest one pesin.
End of Di one wey oda users dey read well well
Odas run comot but three lifeless bodies bin dey for ground wit multiple gunshot wounds for dia body, oga Omoni add.
Doctors confam di bodies dead wen dem carry dem go hospital and now dem put di deadibody for mortuary.
![[Cult clash in Port Harcourt]: "Deaths for Rivers State cult clash as 'US travel advisory' exempt Port Harcourt"](https://ichef.bbci.co.uk/ace/ws/640/cpsprodpb/8AEE/production/_118166553_6b739205-c54d-4ee7-bca6-16748e738a04.jpg.webp)
Di police PRO add say dem arrest one 36 year old Ejike Paul wey dey help dem wit di investigation of wetin happen dia.
Dis dey happun di same day America give travel advisory for her citizens not to travel to Rivers State [wit di exception of Port Harcourt] sake of kidnapping and oda civil unrest.
Tori for town na say pipo dey fear reprisal attacks to follow wetin happen.
Rivers State Commissioner of Police, Friday Eboka dey advise pipo to go about dia normal business as dem don increase patrol for di area and across di oil rich state.












