Trump Easter Message: How pipo react to former US President, Trump ''Radical left Crazies'' Easter Message

Donald J. Trump

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 1 mins

Former American Presido Donald Trump don comot with im own message for Easter.

E tok im message give tori pipo wey remind many of wen im for dey Twitter.

Di short message tok say "Happy Easter to all, wey include di Radical Left CRAZIES wey rig our Presidential election and wan destroy our country."

Di Presidential election bin no dey rigged even as di courts don already rule on di mata say dat claim say e no happun.

How pipo to di Easter message

Many pipo follow chook mouth for di message wey short sotay e be like wetin dey happun wen Trump still dey for Twitter.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Tweet on Trump

Wia dis foto come from, Twitter

Tweet on Trump

Wia dis foto come from, Twitter

Tweet on Trump

Wia dis foto come from, Twitter

Remember say Twitter permanently ban di presido following the US Capitol riot wey lead to di death of six pipo.

Dis, however, no go be di first time di former presido go comot address di nation since im defeat for di 2020 Presidential election.

Im bin announce say im go start im own social media for March and also crash one wedding for im resort for Mr-a-lago wia im bash current presido Joe Biden.