Rapper DMX latest news: Lawyer confam say Earl Simmons suffer heart attack, dey critical condition

DMX

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 2 mins

US rapper and actor DMX dey in serious condition in hospital afta e suffer heart attack, according to im lawyer Murray Richman.

Mr Richman tell US media say e no know weda di heart attack happun as a result of drug overdose, as TMZ bin report.

Di 50-year-old, wey e real name na Earl Simmons, land hospital for White Plains, New York late on Friday evening, Mr Richman tok, e add say DMX dey surrounded by im family.

"E bin dey on life support," di lawyer tok. "Dem don take am off of life support. E dey breath on im own but small brain activity dey."

DMX wey be father-of-15 bin don serve jail sentences in di past on charges wey include animal cruelty, reckless driving, drug possession and weapons possession.

For 2018, e make headlines afta e play one of im own songs to a judge inside court wen e bin dey face charges of tax fraud. Afta di judge listen to di song, e say, DMX na "good man" e come give am one year in prison.

For 2016, e stop to dey breathe and dem gat to revive am inside one hotel car park for New York state.

"Earl na sweet guy," Mr Richman tok. "Earl na pesin wey fit tell ogbonge story. E na pesin wey get something inside. Dis na heartbreaker."

Celebrities offer prayers

Among those wey don call for "prayers" for di rapper, na Ja Rule and Missy Elliott.

Ja Rule tweet: "Prayers up for my brother DMX," while Missy Elliott add say: "Prayers for DMX and im family."

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Rick Ross also call for prayer for DMX for im Instastory.

Odas wey don call for prayers na actors Gabrielle Union and Viola Davies

Gabrielle Union screengrab

Wia dis foto come from, TWITTER SCREENGRAB

Who be DMX?

DMX na one of di biggest rap stars during di 1990s.

Dem born Earl Simmons wey pipo sabi with im stage name DMX, (Dark Man X) on December 18, 1970.

E be American rapper and songwriter. E begin dey rap for di early 1990s, and release im debut album It's Dark and Hell Is Hot for 1998.

Na for 1999 e release im best-selling album, ... And Then There Was X, wey include di hit single "Party Up (Up in Here)". Since im debut, DMX don release seven studio albums.

During di 1990s, DMX bin form close bond with fellow up-and-coming rappers Jay Z and Ja Rule, di three bin collabo each oda many times and form group, Murder Inc. But di group no last.

DMX don also feature inside films like Belly, Romeo Must Die, Exit Wounds, Cradle 2 the Grave and Last Hour.

For 2006, e act for di reality television series DMX: Soul of a Man, wey dem show for BET cable television network.

For 2003, DMX publish a book about imself, titled, E.A.R.L.: The Autobiography of DMX.

Di rapper get history of addiction, e don speak about im addiction to cocaine before and don dey in and out of rehab ova di years.