Niger State GSC Kagara school kidnap update: Governor Abubakar Sani Bello order closure of all boarding school

Nigerian Army say dia troops dey pursue di bandits wey kidnap members of staff and students of Government Science School, Kagara for Rafi Local Government Area of Niger State on Wednesday.
Dis wan dey come as di state Governor, Alhaji Abubakar Sani Bello don order make all boarding schools for four local government areas of di close till further notice.
Di govnor wey give di directive on Wednesday for di state capital say di affected council area be Rafi, Mariga, Munya and Shiroro.
Before, na only schools wey dey Rafi, Munya, Mariga and Shiroro local government areas dem close.
Di govnor follo tok say goment no go pay any ransom to secure di release of anybody wey dem kidnap, say na so dem go use di money take buy ammunitions.
"We no go pay ransom or negotiate wit bandits as dem go use di moni to buy sophisticated weapon to kontinu to do bad tins."
Meanwhile, Secretary to Niger State goment, Ibrahim Matane bin confirm di incident to BBC News Pidgin say di armed men attack Government Science College Kagara around 3am local time on Wednesday.
Matane say dem (di 'bandits') bin wear school uniform wen dem storm di school and over power di security guards dem before dem kidnap di school students dem.
End of Di one wey oda users dey read well well

'27 students dey miss'
Niger state govnor confam say na 27 students, 3 staff and 12 members of dia family na im di gunmen abduct on Wednesday morning from Government Science College, Kagara for Rafi local government of di state.
E say di total number of students for di school be 650 and dat di bandits kill one student by name afta im try to escape for di presence of oda students.

Di govnor also confam di viral video wey show bandits dey celebrate di abduction of passengers of di NSTA bus wey dem attack on Sunday wia dem di demand for N500 million.
Di governor say e no be goment policy to pay ransom.
E follow assure di pipo of di state say dem go make sure dem guarantee di safe return of di victims and dat di goment no go sleep until dem rescue all di pipo dem abduct.
E also para give say di bandits attack for di state don pass be careful and e beg di federal goment to epp deploy evri necessary resource.
More pictures from Kagara:








![[Niger State] GCS Kagara school kidnap update:](https://ichef.bbci.co.uk/ace/ws/660/cpsprodpb/1405F/production/_116151028_kankaraadbductionrescue.jpg.webp)






