Georgia election runoff: Democrats take control of US senate as Warnock and Ossoff win

Wia dis foto come from, Reuters
Di Democratic Party of US President-elect Joe Biden win control of di Senate - and of Congress overall - with two victories for di state of Georgia.
Raphael Warnock and Jon Ossoff defeat Republican incumbents Kelly Loeffler and David Perdue respectively.
Democrats go now control di Senate, the House of Representatives and the White House for di first time since 2009.
Na like four million Georgians turn up to vote for di run-off election.
Di result na serious blow for outgoing Republican President Donald Trump.
Dem do re-run of di election because none of di candidates for di November general election achieve di 50% needed for victory under state rules.
Di result na blow for outgoing Republican President Donald Trump.
Mr Warnock na di first black senator for di state of Georgia - a slavery state for di US Civil War - and only di 11th black senator in US history.
End of Di one wey oda users dey read well well
Claiming victory, Mr Warnock pay tribute to im mother, Verlene, who as a teenager work as farm labourer.
"Di oda day - because dis na America - di 82-year-old hands wey bin dey pick cotton for somebody else go to di polls and pick her youngest son to be a United States senator," e tok.
Although Mr Biden Democrats go need to take both seats to gain full control of Congress, di Republican party of outgoing President Donald Trump need only to win one in order to retain di Senate. Democratic candidate Raphael Warnock dey projected to win di first of two nail-biting Senate races for Georgia, against Republican Kelly Loeffler.
Wetin e mean?
With di result for Georgia, di Democrats and di Republicans go now get 50 seats each for di Senate, di upper house of Congress.
However, di incoming Democratic vice-president, Kamala Harris, go preside over di Senate once she takes office and go get di tie-breaking vote.
Dis one go give di Biden administration greater chance of achieving dia agenda on issues such as healthcare and climate change.
Di Senate also get di power to approve or reject Mr Biden nominees for cabinet and judicial posts.
How close di votes be?
Both races dey very very tight. Mr Warnock defeat Senator Kelly Loeffler by a projected 50.7% to 49.3%, according to figures from di Associated Press.
Jon Ossoff go ahead of Senator David Perdue, 70, with 50.28% to 49.72%.

Wia dis foto come from, Reuters
Who be di senators-elect?
Raphael Warnock, 51, na pastor for di Ebenezer Baptist Church for Atlanta - di church wia civil rights leader Martin Luther King once preach.
Mr Warnock be one time youth pastor for New York City for di 1990s before e move to Baltimore, one of di poorest cities for di US.
Jon Ossoff, 33, na documentary filmmaker, dem born am for Atlanta. As high school student, e intern for John Lewis, di civil rights campaigner and congressman wey die for 2020.
Democrat never win Senate race in Georgia for 20 years but di party don dey boosted by Mr Biden presidential election win over Mr Trump dia. Mr Biden margin of victory na about 12,000 votes among five million wey dem cast.












