You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
January 1: New Year, but no be di way we know am
Millions of pipo around di world dey say bye bye to 2020 as dem dey start 2021, but di coronavirus pandemic don make many pipo celebrateinside dia parlor.
As lockdown or restrictions dey in some kontris, dem don tell would-be New Year partygoers to coole bodi for house.
Some attend ceremonies or festivals wit mask plus dem follow other prevention protocols.
For Tokyo (below), pipo visited di Kanda Myojin Shrine to offer prayers. Di popular Shinto shrine reduce di number of visitors e dey allow, as Japan dey face anotda wave of Covid-19 infections.
For Wuhan, China, crowds gada for di city wit balloons and fine fine cloth to count down to midnight on New Year's Eve.
Fireworks colour colour di night sky for Taiwan to mark di beginning of 2021 as many cities move dia own celebrations go online.,
Like dis family for Seoul, South Korea, many pipo for di world do di celebration small and inside dia house.
For di Philippines, groups gada for one park for Manila (below) to watch fireworks display. Authorities draw ear give warning make pipo no form large crowds.
End of Di one wey oda users dey read well well
For Hong Kong, pipo gada for front of Victoria Harbour to celebrate togeda.
E cold wella for di celebration for Yekaterinburg, Russia, as pipo full ground for di city hall...
While for di United Arab Emirates, one of di largest New Year fireworks displays do wawu colours wey light up di sky for di emirate of Ras al-Khaimah...
Fireworks around di tallest building for di world, di Burj Khalifa, as di clock strike midnight for Dubai.
Inside Moscow, residents near di Red Square see beta firework for di St Basil's cathedral and di Kremlin as Russian authorities ban crowds.
Fireworks and light show shele for different parts of London.
All pictures copyright