Boxing Day meaning: Why dem call day afta Christmas Boxing Day

Wia dis foto come from, Getty Images
Boxing Day - di day afta Christmas day - get di name wen Queen Victoria still dey throne during di 1800s and e get notin to do with di sport, boxing.
Di name come from time wen di rich bin dey box up gifts to give di poor.
Boxing Day na traditional day wey servants dey get dia off, and di day wen dem they receive special Christmas box from dia masters.
Di servants go also then go home on Boxing Day to give Christmas boxes to dia families.
Di day also get religious connections and dem dey celebrate am as Saint Stephen's Day for Ireland and di Catalonia region of Spain.
For some European kontries - like Hungary, Germany, Poland, and di Netherlands - dem dey celebrate Boxing Day as a second Christmas Day.

Wia dis foto come from, Getty Images
Collection money
Church dem also play role for di creation of Boxing Day.
Through out di year, dem go collect money from churchgoers in di form of collection and give am out for Christmas.
End of Di one wey oda users dey read well well
Many of dem dey store di collection money inside box, we dem dey open on Christmas Day.
Dem go come give di money to di poor pipo di next day - on Boxing Day.
Today, those boxes no popular like before.

Wia dis foto come from, Getty Images
Wen be Boxing Day?
Boxing Day na di day afta Christmas Day and fall on 26 December.
Na also public holiday for Nigeria and some oda kontries around di world.
Wen 26 December na Saturday, di Boxing Day holiday go move to di next Monday.
If 26 December fall on Sunday, den di holiday na di following Tuesday.

Boxing Day Traditions
Football
Christmas Day now na football-free zone, but dis no be how e dey happun before.
Na for di 1950s, tins begin change and to dey play sport on Christmas Day change.
Di final Christmas Day football match happun for 1957, dis one make Boxing Day di traditional festive fixture.
Groove and food!
For Nigeria, Boxing Day for many na day to groove afta all di cooking and receiving visitors on Christmas Day.
Na also day to continue all di chopping because many pipo dey prepare so much food for Christmas wey dem go end up eating throughout di next week.

Wia dis foto come from, NURPHOTO VIA GETTY IMAGES
Christmas Day
Happy Christmas Day dey celebrated by mainly Christians in most of di kontris in di world with a view to celebrating di birth of Jesus Christ.
But di 2021 Christmas celebration dey happun inside di coronavirus pandemic wey don dey for about two years now.
On di occasion of dis day, over two billion pipo meaning at least one-third of di world population go celebrate di day.
Though no specific detail on di exact date or year wey dem born Jesus Christ dey inside di holy book of di bible, Christians celebrate Jesus' birthday on December 25.
Na sake of dis why many pipo dey also celebrate di day on different dates.
Christmas season na one of di most joyous festival of di year as na dat time of di year wey pipo dey relax, jolly, flex, give gifts, travel, worship, visit friends and families.
Di celebration dey always follow wit decorations, gifts, cakes, correct food, Christmas carol and holiday.
Na also dat time of di year wen pipo dey come togeda to say bye-bye to di year, welcome di new year and pray for a peaceful and prosperous new year.














