Parliament of United Kingdom vote international sanctions against Nigeria

Parliament of United Kingdom vote in favour of international sanctions alias special punishment against Nigeria sake of EndSARS protests and how goment handle di mata.
UK parliament on Monday for debate wey members of di Petitions Committee of di House of Commons do, dem agree say Nigerian officials dey involved in di claim of excessive use of force on peaceful protesters during di 20 October, 2020 anti-police brutality demonstrations.
Members of United Kingdom Parliament also blast di goment of President Muhammadu Buhari for di attack and intimidation of protesters wey take part for #EndSARS demonstrations.
Di non binding vote na as a result of one petition before di UK parliament wey more than 220 thousand pipo sign.
Dem threaten to sanctions goment officials and security agents wit visa ban, freezing of assets and to stop di funding and training for Police.
Nigerian authorities don continue to deny say security forces open fire on peaceful protesters.

Wia dis foto come from, Screenshot/UK Parliament
Na on 12 November 2020. goment for United Kingdom [UK] don answer di petition wey Nigerians sign to ask make di commonwealth kontri put sanctions ontop di head of Nigerian leaders as "punishment to anyone involved in violation of human rights".
According to dis petition, Nigerians tell di UK goment to use policy wey allow dem sanction anyone wey no respect human rights around di world.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di UK parliament for dia response say dem dey concern about di violent wey happun during di EndSARS protest and dey wait for di investigation of di Nigerian goment into reports of police brutality for di kontri.
UK Parliament dey consider all petitions wey get more than 100,000 signatures for a debate. So far di EndSARS petition from Nigeria don pass 200 thousand signatures.

Wia dis foto come from, EPA
EndSARS protest against police brutality turn violent afta thugs attack di peaceful protesters and later begin dey vandalise both properties of goment and private citizens.















