Chief Emeka Morocco Maduka: Death of Morocco Maduka wey be top Nigerian highlife musician

Chief Emeka Morocco Maduka, wey be top Nigerian highlife musician don die.
Morocco Maduka die on Thursday 29 October, 2020 one of im close padi confam to BBC..
Chukwudi Avoaja wey be member of di joinbodi of musicians for southeast Nigeria PMAN, wey also play music wit am [Morocco Maduka] say dem bin dey plan to do birthday party for am on Sunday before di news of im death land.
Morocco Maduka na popular musician wey im music dey touch for body.
For interview wey im bin do wit BBC, Morocco Maduka tok say im be electrician before im enta into music.
Who be Emeka Morocco Maduka
- Emeka Morocco Maduka dey popularly known as King of Ekpili music and dem born am for Ukwulu, Anambra state.
- Chief Dr. Emeka Morocco Maduka, start im music career for di age of 12 and today im be di oldest performing musician for di East of Niger.
- E release im first album titled Aya Nigeria (Nigerian War) for 1971 and e don get up to 120 albums so far .
- Di King of Ekpili music bin tok for one interview with di Sun news online dis year say I clock e go retire from music wen im clock 80 years;"I be 76 years old now, so wen I clock 80, I go celebrate my birthday and then retire. dat na one of di plan wey I get."
- E also tok say im dey plan to release one album dis year and e don dey work inside studio, recording some new songs and wen di work don dey complete, e go release di album.
- Chief Emeka Morroco Maduka marry afta di civil war; dat na for 1971 and dem born 4 boys and 4 girls
- On March 6, 2020, Chief Emeka Morroco Maduka bin wan do one historic event to mark im 60 years on stage but later postpone am to October 23 and 24, 2020







