Maurice Kamto, Cameroon CRM party leader still dey house arrest a week afta anti-Biya protest - Lawyers give latest update

Maurice Kamto, Cameroon CRM party leader

Wia dis foto come from, Maurice Kamto

Wetin we call dis foto, Maurice Kamto, Cameroon CRM party leader
Read am in 2 mins

Lawyers of Cameroon Renaissance Movement, CRM party leader, Maurice Kamto say deh don ready for show-down wit security forces for see dia client as tight security still dey for junction and all around de house.

Maurice Kamto dey for house arrest since 22 September and lawyer di plan for storm si opposition e house for Santa Babara quarters for afternoon.

One of de lawyers, Emmanuel Simh don tell BBC News Pidgin say deh no even know Kamto e health condition, how e di live de situation as no man nova see yi since.

"We don ready and we know how we security forces di behave, but we don ready to go get informate for form file for defend we client as goment wan take legal action".

Anoda lawyer Robert Amsterdam, international lawyer weh Kamto bin employ for check issues about de 22 September march say e tok for phone and e dey for house arrest since.

Amsterdam say na illegal move from president Biya regime.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Last Monday, Kamto bin announce peaceful march for tell president Paul Biya for komot for pawa as e no fit solve Anglophone crisis, Boko Haram and stop for violate pipo dia rights.

According to Cameroon CRM party, as some party supporters komot march, deh arrest about 600 and some families di still search for dia relations weh deh no see afta de march.

Maurice Kamto, Cameroon CRM party leader

Wia dis foto come from, Maurice Kamto

Wetin we call dis foto, Maurice Kamto, Cameroon CRM party leader

But since den, Kamto and e family nova komot for house and e tweet dis morning say, e get correct informate say goment wan 'attack' arrest yi, di party add.

Kamto add say taim for face violence again from 'outdated regime' don reach, and e don remain for house for nine days now and di wait de next goment action.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

Rene Emmanuel Sadi, goment tok-tok pesin for week-end say deh di study Kamto e case and goment fit take legal action.

Also, say Ministry of territorial administration di shine eye for de party for see de next action for take.

Before now goment bin don sound warning say deh go ban CRM party and deh bi warn say any man weh eh komot march go face de law.