Big Brother Naija housemates Erica and Kidd Waya do 'everitin' for Head of House lounge, Ngozi Nlewedim reveal

Wia dis foto come from, ScREENSHOT/BBNaija Youtube
Video of how Erica admit say Kidd Waya wit her do blow job and 'everitin' for Head of House Lounge inside Big Brother Naija 2020 lockdown season don show.
On Wednesday night na im Erica wey real name na Ngozi Nlewedim reveal dis open secret to fellow housemate Neo.
"If dem show videos of all di tins wey happun for dat head of house lounge, ehhh Jesus, even me I no wan watch, I go dey so embarrassed"
As Erica dey tok, Neo ask her weda she do 'blow job?' and she admit say she do everitin
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Na while di housemates played anoda round of di spelling bee inside di garden, na im Erica wey dey currently serve as BBNaija Head of House for second time take di opportunity to reveal di mata to Neo.

Wia dis foto come from, BBNAIJA TWITTER
Just di odo day fans dey react afta Erica of Big Brother Naija blast kiddwaya on Friday night about dia relationship inside di house.
Many of dem dey wonder if di "Kiddricca ship" as dia fans dey call dem don crash sake of wetin Erica tok.
Tori be say Kidd Waya and Erica na strong padi padi sotey marriage tok ontop dia mata don dey fly up and down.
End of Di one wey oda users dey read well well











