Africa coronavirus infection cases witness 20 per cent drop - See how e happun

Africa Centre for Disease Control say di continent don witness up to 20 per cent drop for di number of new infections of coronavirus cases since di past one week.

For beginning of August, Africa bin get more dan 15,000 new cases of Covid-19 per day. Today, di cases na less dan 10,000 per day.

Kontris wit di biggest number of cases like Nigeria, South Africa, Kenya and Egypt don dey see less cases so di number wey dem dey report don reduce.

But according to some sabi pipo dis fit no be beta news. Dem dey wonder weda na sake say di kontris no dey do enough tests. Many don abandon random testing, instead dem just face areas wia reported cases dey.

Africa CDC add say make pipo neva ova jubilate forget dem sef no take precaution.

E say communities must to shine dia eye well well to make sure say di virus no spread.

Di CDC dey also worry about di increase in confam cases for Tunisia, Morocco, Uganda and Burkina Faso.

East and North Africa still dey record increase for daily cases of Covid-19.

Now Africa get more dan 1.2 million Covid-19 cases and more dan 28,000 deaths. More dan 900,000 pipo don recover.