Iphone 12: Wetin be dis refresh-rate display wey fit dey di new Apple phone?

iPhone 12: iPhone 7 exhibited in Apple store, China, 2016

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, iPhone 7

Di coronavirus pandemic don slow down di release of di latest iPhone but pipo dey anxious to see di features wey go dey inside di new phone.

One of di possible feature wey dem dey talk about now na di refresh-rate display. Phone lovers bin dey anticipate say di refresh-rate fit increase to 120Hz. Di highest refresh-rate for latest iPhones wey dey market na 60Hz.

If na true say dis feature dey come with di new iphone, e no go be new tins for oda phones. Samsung Galaxy s20 5G OnePlus7T, Google Pixel 4 XL and some oda phone don already get 90Hz and 120Hz.

Wetin be dis refresh-rate display?

iPhone 12

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Apple CEO Steve Jobs bin die in 2011, at age 56

Di refresh-rate dey measure how quick phones fit display updates. Dis one mean how many times content for phone screen dey refresh per second. Dis feature dey very important for phone wey get high interest for game.

Smartphones with high refresh-rate display dey allow users to experience smooth interface for dia phone, and dey make to dey watch something for phone dey sweeter as di picture and graphic go clear and sharp well-well.

Dem dey measure di speed of di refresh-rate with Hertz (Hz).

Di reason why dis new refresh-rate dey sweet pipo never dey clear sake of say, except na for game of big video content, high refresh-rate no too get big significance for phone.

Bad tins for high refresh-rate

iPhone 12: iPhone 7 exhibited in Apple store, China, 2016

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, iPhone 7

High refresh-rate dey chop battery. Dis one mean say phone wey get 90Hz and above go need to get high power-life or di phone go dey quick die. For Africa and Nigeria wey electricity be major challenge, users from dis part of di world fit no enjoy am.

Ogbonge phone analysts dey encourage make pipo reduce dia refresh-rate wey pass 60Hz from dia phone so dem no go suffer battery wahala.