Nigeria police recruitment 2020: NPF screening 2020 update, location and date around Nigeria

Nigeria Police Force don deny tori wey dey fly upandan say di Inspector General of police don waive entry requirements into di force for di recruitment screening exercise wey dey happun across di kontri.
According to force tok-tok pesin, tori pipo no understand di signal dem send wen dem report say pipo with bow legs, and oda physical challenge fit apply and qualify.
"Di recruitment policy of di force dey statutory, nobody fit change am because we dey recruit in accordance with di law.
"Dem don give dem benchmark, di signal only tok say make dem no drive pipo comot ontop wetin dem see, go ahead and screen dem, use di benchmark and do your report say dis pesin qualify or dis pesin no qualify because e too short or get belle and no go fit undergo strong training or say e no qualify because e get K-leg. But no drive dem comot, grant dem access e just be like fair hearing." Na so Mba tok.
Dis one dey come as di Physical/Credential Screening for people wey apply to join Nigeria Police Forece as Constables don begin.
On Monday evening di Nigeria Police Force release nationwide locations of wia screenings for pipo wey apply to join di Nigeria police force as constables go happun.
Di screening exercise start on 24 August and go end 6 September, 2020. Di exercise go take place for di 36 States of di kontri plus Abuja, di kontri capital.
How di screening exercise go be step by step
Candidates for di exercise wey must very patient as dem dey come di screening and must come di screening ground wit dia white T-shirt and short wit photocopies of all dia credentials and den follow dis steps:
End of Di one wey oda users dey read well well
● Wash dia hands wit soap and water and observe all di Covid-19 protocols
●Fill bio-data form wit all dia relevant information
● Do physical examination wia dem go take di measurement of dia height and chest. Dem go also check dia body for scars and tatoos
● Di next table go screen dia documents to see if di candidates come wit all di listed required documents complete like dia O'level certificate, birth certificate/age declaration, guarantor's form, local goment identification and National identity card/slip.
● Den screen to see if di candidate meet di required qualifications especially di O'level 5 credits
● Di security screening go check if dem get any criminal record before from di security/intelligence data base
●Di final table go recommend weda dem meet all di criteria or not
⚫️Den ICT desk go input all di data dem don screen send am go Police headquarters wey go shortlist pipo wey dey successful.
Candidates wey successfully scale through dis process go pass through anoda round of tests wia dem go write examination.
See di locations and dates for NPF shortlist 2020:
South East

Wia dis foto come from, Nigeria Police
North West

Wia dis foto come from, Nigeria Police
North East

Wia dis foto come from, Nigeria police
South West

Wia dis foto come from, Nigeria Police
South South

Wia dis foto come from, Nigeria Police
North Central

Wia dis foto come from, Nigeria Police















