Nigeria Police recruitment 2020 screening go begin August 24 - See wetin you go need for di exercise if you apply

Wia dis foto come from, Twitter/police
Good news don land for di plenti Nigerians wey apply to work as Constable for Nigerian Police force.
Nigerian police announce on Thursday say all those wey complete dia online recruitment exercise go begin dia screening between 24th of August to 6th of September.
- Nigeria police recruitment 2020: See Aug 24 screening locations for Lagos, Rivers State
- How to update your record on top Nigeria Police recruitment portal
- How much be Nigeria Police salary? Plus oda tins you need to know as di force begin recruitment
- Meet di 'presidential candidate' wey her video dey make pipo tok
Di screening exercise go happun for different location across di 36 states of di kontri and dem go check weda di applicant dey physically fit plus get correct certificate.
All di applicants gats wear clean white T-shirt and short to dia various screening venues
See di basic documents wey dem gatz bring join bodi be
- National Identity Number
- Original and duplicate copies of credentials - O' Level Result(s)
- Certificate of Origin
- Birth Certificate/Declaration of Age and dem suppose arrange dem for inside two white flat files wit recent passport photographs
- Printout of application submission confirmation page
- Guarantor's form must dey complete
Di police tok -tok pesin, Frank Mbah say any pesin wey show for di screening centre without all these tins, no go follow do di screening .
E further explain say di screening go happun for different location for di 36 state of di federation including FCT. And all di details and guideline for di specific areas dem go soon come out.
E add say di screening exercise go dey in line wit di Covid-19 protocols.
E also explain say di exercise dey free and say di Inspector General of Police don assure say di process go dey free and fair.
End of Di one wey oda users dey read well well













