You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
JAMB post UTME screening: University of Nigeria, BUK, AKSU, Moshood Abiola, Auchi Polytechnic don begin sell form for 2020/2021 admission screening - see list of schools here
Some higher institutions for Nigeria don begin to dey call candidate wey wan come alias gain admission into dia school to begin buy form for post UTME.
Di Joint Admission and Matriculation Board on Monday tok say dem don order all di school make dem no fix any day before 7 f September for post-UTME examination.
Di board say di order na to make sure say all di candidate wey write dia exam and use awaiting result get equal opportunity for di exam.
Dis na di schools wey don start to dey sell forms to students.
1. Bayero University, Kano say dia aptitude test for 2020/2021 Admission exercise registration don start on Monday, 3rd August 2020.
2. Di Management of Moshood Abiola Polytechnic, Abeokuta don announce say dem go start to sell form for Post-UTME applicants wey want Full-Time admission into dia school for dis session.
End of Di one wey oda users dey read well well
3. Candidates wey score 160 and more for 2020 UTME to go fit register for post UTME of Akwa Ibom State University (AKSU). Also Direct Entry (DE) candidates too fit join for di exercise.
4. University of Nigeria, Nsukka also don begin to dey tell student wey choose di school as first choice and score 180 for JAMB fit begin online registration for post UTME.
5. Auchi Polytechnic too don start to dey register candidate for post-UTME.
We still dey chook eye for dis tori, abeg refresh dis page as we still dey update di list of schools.
Di Joint Admission and Matriculation Board (JAMB) for Nigeria don order say 2020/2021 post-Unified Tertiary Matriculation Examination screening must start September 7.
Jamb tok tok person wey follow BBC Pidgin tok say di new date na to make sure say everybody get chance to do dia Post-UTME including student wey register with awaiting result.
Joint Admission and Matriculation Board reach di agreement on Monday afta dem do meeting with Vice-Chancellors, Rectors, and Provosts of tertiary institutions.
Before, di board bin don issue guideline for all tertiary institutions to start dia admission with effect from August 22.
"We come out with resolution after di meeting say no post-UTME exercise must happun before September 7 to October 4.
"Also for pipo wey go write dia post-UTME on September 7 to October 4, we go need do anoda one for November 18 sake of candidate wey go do NABTEB.
"di reason for dia date na say at di end of di day, all di results go don comot and everybody go don get opportunity to compete.
"For schools wey no go do any screening exercise, wey be say na only JAMB dem go use, dem fit start to dey make recommendation and to choose dia candidates but dat process no go end until sometimes in November or end of November wen goment go announce close of admission.