Michelle Obama: 'Low-grade depression' mood na im former US first lady say she dey face now

Wia dis foto come from, Getty Images
Former US First Lady Michelle Obama say she dey suffer from "low-grade depression" because of di pandemic, racial injustice and di "hypocrisy" of di Trump administration.
Madam Obama tok say she bin dey find am hard to do her normal exercise to sleep.
"I dey wake up for middle of di night because something dey give me worry or something dey make my heart heavy."
She tok dis one during di second episode of her podcast, wia she interview US journalist Michele Norris.
"Dis no be better times, spiritually," Madam Obama tok. "I know say I dey deal wit some kain low-grade depression.
"No be just because of di quarantine, but because of di racial palava, and to dey see dis administration, and dia hypocrisy, day in and day out, e dey drop pesin spirit."

Wia dis foto come from, Reuters
She also say e dey tire her wella to to dey "wake up to hear anoda tori of one black man or black pesin wey dem treat anyhow, or wound, or kill, or dem lie ontop im head for something im no do."
Wetin she dey take cope?
End of Di one wey oda users dey read well well
Di former first Lady of America say for her "to dey plan tins na di solution" wey she dey use manage dis feelings - and say to maintain dat pattern don become even more important for her inside di pandemic.
For di first episode of di podcast she interview her husband Barack Obama, wey bin dey office before Donald Trump.

















