Black Lives Matter: American Senator describe slavery as 'necessary evil'

Senator Cotton

Wia dis foto come from, Getty Images

One Senator for di state of Arkansas, US don describe slavery as "necessary evil" wey dem use take build America.

For local newspaper interview, Senator Tom Cotton wey dey di Republican party say im no gree wit di idea say racism dey inside di blood of America.

Im dey introduce bill wey go ban federal funds for one project by di New York Times Newspaper wey suppose change di historical view of slavery.

All dis yans dey come as di Black Lives Matter movement dey rise. Di death of George Floyd for Minnesota for May bin cause serious protests against police brutality and racism for di US.

Senator Cotton don show strong opposition to di nationwide protests sotay im describe dem as "joinbodi of katakata". Im support President Donald Trump threat to use sojas to quench di protests.

Di Senator tell di Arkansas Democrat-Gazette say, "We need to study di history of slavery and di role and impact wey e get on di development of our kontri because if we no do am, we no fit understand our kontri.

"As di founding fathers tok, na necessary evil wey dem use build di union, but dem build di union in di kain way to put slavery to end."

Senator Cotton don deny say im dey prove say slavery dey right.