Chrissy Teigen, John Legend wife block one million pipo for Twitter sake of dis reason

Wia dis foto come from, Getty Images
American model Chrissy Teigen say she don block one million pipo comot her social media account because dem dey worry her and now she no get dia time again.
For tweet, di model wey be US musician John Legend wife abuse dis pipo she block, say dem be "sick psychopaths".
"Psychopath" na name of pesin wey get mental sickness, wey no fit feel di kain emotion wey oda pipo dey feel.
But wetin dis pipo do madam Teigen?
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Dis fit relate to one scandal about convicted child sex offender Jeffrey Epstein.
Some pipo bin come out to accuse Teigen say she bin travel, wit her husband, inside di late Epstein plane and even follow am do di bad work to recruit underage girls for di crime.

Wia dis foto come from, Getty Images
Teigen don deny dis accuse and maintain say she no get anything to do wit Epstein.
But di abuse come gada strength afta authorities recently arrest oga Epstein girlfriend Ghislaine Maxwell and accuse her too of sex trafficking.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di day before, on 14 July Teigen confam say she don delete 60,000 tweets.

Wia dis foto come from, Getty Images
For Twitter, madam Teigen say she no wan hear advice of "no give dem ear, na trolls dem be" because although she don block one million, di "sick psychopaths" still dey worry her.
She para her accusers - wey she call "trolls" - no gree her rest and say na dis kain tin dey sweet dia belle.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
She go on to thank pipo wey don help her during dis gbege. She mention one journalist Yasha Ali for im ogbonge help, even say she love am.











