Coronavirus: See how students for dis African kontris dey help fight coronavirus

Blue protection cloth wey pesin wear
Wetin we call dis foto, Cloth wey fit protect healthcare workers like dis one follow for wetin Africa students don produce to fight coronavirus
Read am in 2 mins

As kontris all over di world dey face shortage of important tins to use fight coronavirus, students for Africa don step forward to show say dem too fit contribute dia knowledge.

We look at some of di ogbonge tins wey some students for higher institution for Africa dey do.

Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Instagram post

Ventilator - Usman Dalhatu (Nigeria)

Dis ventilator na di work of Usman Dalhatu wey be 200 level Nigerian engineering student for Ahmadu Bello University, Zaria.

Usman Dalhatu carri ventilator wey im build

Wia dis foto come from, Instagram / Usman Dalhatu

Wetin we call dis foto, Usman Dalhatu say im ventilator dey wait for approval

Usman wey follow BBC tok say na one month e take am to build di ventilator and im don already get plans to produce up to twenty of am. Di only tin im dey wait now na approval from Federal Teaching Hospital, Gombe, wey fit come any time now.

Skip Facebook post

Content is not available

View content on FacebookDe external site no concern BBC.

End of Facebook post

Facemask - Taha Grach (Tunisia)

As billions of pipo all over di world turn to facemask as dia first line of protection against coronavirus, di product don scarce so tey e be like gold for some places.

For Tunisia, northern Africa, students for di National School of Engineering for Sousse don begin produce facemask wit 3D Printing - wey be ogbonge technology to manufacture almost anytin.

Grach na one of di six students wey involve for di production and e tell BBC say dem dey make 300 per day.

Wetin we call dis Video, Students for dis Kenya university on dia own decide to make medical equipment.

Sanitizers, Facemask, PPE - (Kenya)

Students for Dedan Kimathi University of Technology for Kenya decide on dia own, to begin make important tins like sanitizer, facemask, personal protective cloth, afta dem see say many pipo no fit afford am.

Di Vice Chancellor of di school say Ndirangu Kioni say even N95 follow for one of di tins dem dey do.