'Every foreign student here wan go home' - Ghanaian student inside Wuhan lockdown

Wetin we call dis Audio, "Every foreign student here wan go home"

One Ghanaian student don tell BBC about di serious gbege wey foreign students dey inside for di Chinese city of Wuhan, wey don dey on lockdown afta di deadly outbreak of di new coronavirus.

On Monday, Chinese Premier Li Keqiang visit Wuhan, di capital of Hubei province and centre of di outbreak.