Iran attack: Donald Trump tok for speech today say America ready to make peace
America presido Donald Trump react on Wednesday evening to Iran missile attack by announcing for di end of im speech say US dey ready to "embrace peace wit all di pipo wey want peace."
Oga Trump say, Iran na di "leading supporter of terrorism" and also call Iran General Qassem Soleimani "di world top terrorist."
According to am di death of Iran number two man Qaseem Suleimani go send warning to terrorist all ova di world, come add say, "if you value your life, you no go threaten di lives of our pipo."
Di US presido also tok say none of im kontri pipo die or wunjure for di for Iran attack of dia military base dem wey dey Iraq.
Trump also believe say as Iran don do dia revenge attack do, dia blood don cool down and dat na good tin for di whole world.
As tins be so, Iran dey expect extra "punishment" aka sanctions from America even though dem dey face serious hardship sake of all di punishment wey US don sama dem.
On top of dat, Oga Trump don call Europe to follow am abandon di 2015 Iran nuclear accord or deal and make dem negotiate new deal wit Iran.
Wetin pipo get to say
Jeremy Corbyn say UK Prime Minister no fit challenge president Trump becos in dey depend on US trade deal wit United States
End of Di one wey oda users dey read well well
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1

End of X post, 2
US Department of state tok dia own join.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 3
Pipo no satisfy wit Oga Trump tok say General Soleimani na terrorist and murderer or wetin im mean by saying kill him go make America safe.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 4
Some America pipo dey provoke for di Democrat politician and Speaker of US House of Representative Nancy Pelosi, say she no dey shame as she no support di president.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 5