Election result 2019: Voters for UK dey go vote - See di general election inside foto

Labour leader Jeremy Corbyn, Tory leader Boris Johnson, SNP leader Nicola Sturgeon and Lib Dem leader Jo Swinson cast their votes

Wia dis foto come from, Reuters

Di UK dey go polls for di kontri third general election in less dan five years.

Di contest, go be di first wey dem go hold for December for nearly 100 years, e dey follow di elections wey dem do for 2015 and 2017.

Polling stations for 650 constituencies across England, Wales, Scotland and Northern Ireland open for 07:00 GMT and close by 20:00 GMT.

Prime Minister Boris Johnson, Labour leader Jeremy Corbyn, Liberal Democrats leader Jo Swinson, SNP leader Nicola Sturgeon, DUP leader Arlene Foster, Greens co-leader Jonathan Bartle, and Sinn Fein's Stormont leader, Michelle O'Neill, all of dem don snap foto as dem dey to vote. We neva see Plaid Cymru leader Adam Price yet, but dey keep eye on am.

Hundreds of voters wey dem believe say na student no fit vote for Wales afta dem no register correctly.

Di hashtag #dogsatpollingstations don dey trend for UK as social media users dey share foto of dia "pawlitical" companions.

See di foto dem:

Boris Johnson

Wia dis foto come from, AFP/Getty

Wetin we call dis foto, Boris Johnson dey cari im dog waka go polling station to cast im vote
Jeremy Corbyn

Wia dis foto come from, AFP/Getty

Wetin we call dis foto, Jeremy Corbyn pose for picture for im local polling station for north London
Nicola Sturgeon
Wetin we call dis foto, Nicola Sturgeon cast her vote for Glasgow
Lib Dem leader Jo Swinson and her husband Duncan Hames leave polling station

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Jo Swinson also voted in East Dunbartonshire, accompanied by her husband Duncan Hames
A launderette for Oxford wey dem dey use do makeshift polling station

Wia dis foto come from, PA Media

Wetin we call dis foto, Voting go happun for schools, churches, town halls and more unusual locations, including wia dem dey wash cloth
Workers dey prepare signs outside one polling station on general election day for London, Britain, December 12, 2019.

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Workers dey prepare signs outside one polling station on general election day for London
Plenti pipo no fit vote for Cardiff sake of error
Wetin we call dis foto, Plenti pipo no fit vote for Cardiff sake of error
Polling station for Dobcross, Greater Manchester

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Polling station for Dobcross, Greater Manchester
Polling station sign

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, Polls open across di UK for 07:00 GMT
Polling station for Hampshire

Wia dis foto come from, PA Media

Wetin we call dis foto, Polling station for Hampshire
Polling station for South Belfast

Wia dis foto come from, PA Media

Wetin we call dis foto, Polling station for South Belfast
Polling station sign

Wia dis foto come from, EPA

Man for Christmas hat outside one London polling station

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, Man for Christmas hat outside one London polling station

After di polls close by 22:00 GMT, dem go begin count immediately and by Friday morning dem go announce di result.