Fulani herdsmen: 'I no dey supervise Ruga settlement establisment'

Vice President Yemi Osibanjo

Wia dis foto come from, Prof Yemi Osinbajo/Twitter

Nigeria vice president Yemi Osinbajo say no be him dey supervise di Ruga settlement establishment unlike wetin tori pipo dey report.

Inside statement oga Osinbajo say na di National Livestock Transformation Plan na wey state govnors bin approve under di National Economic Council na im im be chairman.

According to am di Ruga initiative dey different from di National Livestock Transformation Plan.

Tori pipo bin report di general secretary of di Miyetti Allah Cattle Breeders Association of Nigeria tok say, Vice President Yemi Osibanjo office n aim dey help di herdsmen create Ruga settlement for different parts of di kontri.

But according to di statement, di National Livestock Transformation Plan na programme wey dem go first start wit seven states, den afta dem go add six oda states.

"Inside all of dis di federal goment no go force any state goment to give im land," na so im tok.