BBC Pidgin speak with Fulani herdsmen: See wetin dem talk

Wetin we call dis Video, "When we do mistake, we go solve am" - Fulani leader

Fulani herdsmen for South West Nigeria yarn BBC Pidgin say, dem no happy with all di kill-kill wey dey happen for different parts of Nigeria.

For interview with BBC Pidgin tori person Onyinye Chime, leader of Fulani people for Kara, inside Lagos, Abubakar Dan'Ali, say, dem no like as farmers and herdsmen dey kill demself for Nigeria.

He say, even though palava between herdsmen and farmers dey as old as mankind, e dey important to try stop all di kill-kill.

Video by: Onyinye Chime and Joshua Akinyemi